Kenya: Kenyatta don blast judges as election cancel

News imageReuters Kenya President Uhuru Kenyatta dey follow people talk on September 1, 2017 for one Nairobi suburbReuters
President Kenyatta tell im supporters say no shaking; im no dey fear to do another election

Kenyan President Uhuru Kenyatta don change mouth as im enter Nairobi streets for rally, begin call di Supreme Court judges 'crooks,' after those ones cancel di presidential election wey bin announce di President as winner.

Later, President Kenyatta still say make people dey calm, say im go respect wetin court don rule.

Na on September 1 di Supreme court say di August 8 election get some things wey no make am fair; Chief Justice David Maraga talk say as authorities no follow wetin dey inside constitution, im declare di whole thing "invalid, null and void."

Dis one mean say Kenya must do new Presidential election before 60 days pass.

The court ruling no blame President Kenyatta party, or im campaign.

Leader of di opposition party Raila Odinga wey carry di case enter court, begin smile as di court dey read di judgement.

Plenty of Mr Odinga supporters enter street dey jollificate as dem cancel di election.

Di election result and the palava wey follow am don dey make people dey fear say serious riot fit start, like di one wey happen for 2007.

Dis na because as soon as dem announce President Kenyatta as winner, di plenty days of protest wey follow don kill at least 28 people.

Di 72-year-old Mr Odinga talk say di ruling make history for people of Kenya and di whole of Africa.

E say make di members of di electoral commission resign because dem don "rotten."

News imageAFP Raila Odinga (C)AFP
Raila Odinga happy well-well after court announce di ruling.

People dey react

Africa Union don tell Kenya people make dem respect di court ruling. Di Union chairperson Moussa Mahamat say e dey happy as politicians decide to go court, go settle their matter.

News imageDevFin101/Twitter Twitter reactionDevFin101/Twitter
One question wey dey people mind na say: 'So we no fit trust di international observers? Wetin dem dey do here?'

Meanwhile, BBC NewsDay tori person Alan Kasujja enter Twitter to talk say dis ruling don teach other African countries "big lesson."

News imageE.J Nwagboso/Twitter Twitter reactionE.J Nwagboso/Twitter
Dis man say im listen to wetin President Kenyatta tell Kenyans; and e good say Kenyatta message na "peace"

People from everywhere, especially for west Africa don follow put mouth for di matter on top social media, as dis be like di first time wey dem don cancel any Presidential election for Africa.

News imageWangwe Phanto/Twitter Twitter reactionWangwe Phanto/Twitter
Dis person feel say Uganda and Zimbabwe people go surprise say Kenya fit cancel election
News imageAnazodo Eche/Twitter Twitter reactionAnazodo Eche/Twitter
Others dey compare; dis one say if na Nigeria, di case for drag for three years - e want make Nigeria copy Kenya