'We wan see wetin police go do' – NYSC react to assault of female corps members by vigilante group for Anambra

Foto of Anambra state govnor, NYSC logo and screengrab from di viral assault video

Wia dis foto come from, Charles Chukwuma Soludo/Police/Facebook

Read am in 5 mins

Wetin happun to corps members for Anambra State wey vigilante operatives assault still make pipo vex.

Di video of one young lady wey dem identify as corps members for Anambra State wey vigilante operatives bin assault and tear her clothes along wit odas don go viral.

Inside di video, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound and begin beat one lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out.

Wit di video wey dey go viral for social media, di security operatives wit dia guns bin join hand beat di young female corps member wit slaps, blows and di girl dey shout 'please' but dem no leave her.

Di incident happun for Oba, Idemili South Local Govment Area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media.

Di National Youth Service Corps (NYSC) condemn di "unacceptable and dehumanising" attack on di corpers.

Caroline Embu di Acting tok-tok pesin for statement say dem believe in and support di ongoing investigation by di Nigeria Police Force to find out wetin happen.

"Dis we trust go help get justice for di Corps Member in kwesion and any oda aggrieved party,", Embu tok for statement.

She add say "Furthermore, necessary administrative procedures dey go on to assist di Corps member to manage di physiological and psychological trauma resulting from dis unfortunate incident."

According to di police for Anambra State, na di Agunechemba Vigilante Group bin carry out di assault. Dem add say di incident no be recent one as e don happun for July 2025.

However, Anambra authority condemn di act and describe am as unfortunate incident wey no suppose happun.

Charles Soludo speaking into a mic

Wia dis foto come from, Charles Chukwuma Soludo/Facebook

Anambra authority react to assault video

Di special adviser to Govnor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corps member and odas.

E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun.

"Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act."

"We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable."

Di special adviser to Anambra State govnor tok for di interview wit Channels TV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation.

E say dem bin dey pursue some suspected cultists wey run inside di compound wey di mata happun.

According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation.

E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra State but Agunechemba na di state security outfit wey be say na homeland security law create am.

According to di community security adviser for Anambra State, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit "to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am".

E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices.

For dis video wey dem naked di female corps member and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultists into di compound and dem begin search di building.

E say na wetin carry di operatives go dat building be dat.

"Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses."

"Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem."

However, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun.

'We don sabi di suspects' - Police

Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corps member.

"Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved," Anambra State police tok-tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, tok for statement.

E say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable.

Ikenga also say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law.

"Any form remain criminal offence under di Nigerian law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim."

Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation.