'Killaboi' appear for court to face murder charges say e kill him girlfriend

Wia dis foto come from, @AUSTA @KILLABOI INSTAGRAM
Lagos state high court, Igbosere don begin di trial of Benjamin Best Nnayelugo alias 'Killaboi' wey allegedly kill him 21 years old girlfriend for Ajah Lagos.
Police and family members say dem find di deadi body of young Augusta Onwuwagbagbe for her boyfriend house for Oral Estate Ajah for 2023. Dem also tok say dem see her car for di guy compound.
Augusta Onwuwagbagbe wey be student of Leeds City University Ibadan disappear for about three days wey make her family begin search for her.
Di search end for her boyfriend house wia her deadi body lie for ground in a pool of her blood, according to di police.
Wen dem arraign am for court for 17 November 2025, e plead not guilty to di charges.
Dis na after di incident happun for 2023 accused wen e run leave Nigeria bifor im come release videos for online wia im do confession say im commit di murder.
For charge shit wey BBC Pidgin sight on Wednesday, di authorities sama am wit two count charges wey include murder and say e tamper wit him girlfriend body and remove body parts.
Wen case come up in court on Wednesday, Killaboi wear nose mask and black overall attrire wit black wrist watch to match, im hair and bears dey cleanly shaved.
Babajide Martins from di Department of Public Prosecution DPP present one witness wey be di uncle of di deceased wey tell court how dem take find di body of di deceased for her boyfriend house.
How dem find her body - Witness account
Oga Reginald Chinweike Okonye wey be di first witness tell di court say him sister wey be di mother of di deceased bin approach am on July 15, 2023 tell am say she dey try reach her daughter but she no dey pick up.
Say wen di mama chat di girl up via WhatsApp, she go respond on chat but no dey gree pick call.
"We decide to reach to her (deceased) roommate for school wey her name na Oyindamola, she tell us say Augusta no dey too hang out except wit her boyfriend Benjamin".
Oyindamola lead dem to di boyfriend house for Ajah. According to am, pesin no fit enta di Estate except a resident send am entry code.
"We go carry soja from cantonment plus one Mrs Bankole before dem allow us enta di Estate. Dem attach on Estate security man to us wey follow us go Benjamin house" na so e tok.
According to him wen dem reach di house, dem see di deceased car for di compound and di car key dey on top di car bonnet, but di house dey locked.
E say Estate security no gree dem access di house as e dey locked, but direct dem to report di matter for Police Station and get warrant before dem go fit enter di house.
E say "We go report di matter for Ajah Police Station and dem give us two officers follow us go di house".
"Unto say di house dey locked, di officers tell me to climb enta di house through one of di windows wey dey open upstairs" na so e tok.
According to him dem go use money higher ladder wey him use climb to di corridor of di house upstairs.
"I use hand tear net of di window and use my phone torch to look inside, as I look inside, I see di bodi of Augusta dia in a pool of her blood, di bodi don dey swell like say e don reach two days wey she go" na wetin Reginald tell court.
According to him, e distract im sister (di deceased mama) so she no go know wetin im see and tell am say e don dey dark make dem kontinu di search di next day.
However e signal di Police and tell dem wetin him see and agree wit dem to evacuate di bodi. Dem leave di matter to di Police and go home afta dem don give dem money for di evacuation.
E say na di next day e gather friends of di deceased mama and den break di news to di woman.
E say some moments later, di deceased roommate Oyindamola begin send messages to Augusta mama to inform am say di accused dey online dey confess to killing di girl, dey talk say e dey ready to face di consequences.
Reginald say for di video wey go viral, di defendant say im no knowingly kill di girl, say na quarterly dem quarrel wey lead to fight wey make am stab di deceased.
Oga Babajide Martins fro di Department of Public Prosecution wey lead am in evidence show am pictures of di corpse and dat of di house, ask am weda e recognise dem, e confirm say di corpse for dinpicture na him niece Augusta own and di house for di photo na di house dem find di corpse.
During cross examination, di defendant lawyer oga Oru wey be Senior Advocate of Nigeria, SAN ask am weda him take di photos by imself, e say no, but e tell court say im take him own pictures too.
Di SAN also ask am weda e dey dia wen di incident wey lead to di death of di deceased happun, e answer no.
E also ask am weda di IPO follow am climb into di house wen him climb up, e say no.
Justice Harrison adjourn di case to Thursday 5th March 2026 for continuation of trial.
How do case don waka since 2023
After di incident happun for 2023 accused run leave Nigeria bifor im come release videos for online wia im do confession say im commit di murder.
For videos wey im post for im Instagram account, Benjamin say: "I deeply regret di series of events wey lead to dis tragedy, born from a place of pain, betrayal, and toxic arguments.
"I wish say e no ever happun. I no plan for any of dis. Afta di incident, fear take over, and I run away."
For di Video, di suspect bin claim say im dey "prepared to face di consequences, even if e mean death… I dey ready make dem hold me accountable for my actions."
But since afta di confession, Benjamin don run from justice, hide for kontris for Middle East, West Africa and East Asia.
Lagos State Police Command bin declare Benjamin wanted on 13 October 2023, and INTERPOL issue for im arrest for any part of di world.
Police claim say dem first arrest am for Freetown, capital of Sierra Leone, on 20 October 2023 under im fake identity "KANU PRINCETON SAMUEL," but im later escape custody during di prison break wey bin happun for di Freetown for November 2023.
Authorities bin track di suspect to different parts of di world, wit orishirishi fake passports, but dem eventually gbabe am for Doha, Qatar for January, 2025, wit fake Guinea passport under di name "Toure Abdoulaye."
"Through robust international cooperation and use of advanced biometrics, INTERPOL NCB Abuja, collabo wit INTERPOL NCB Doha, to confam im identity.
Qatari authorities arrest am for 2025. Official extradition request, wey police process through Federal Ministry of Justice, Abuja, bin get approval from Qatari judicial authorities, wey result to im repatriation to Nigeria.









