Tinubu appoint 'Tax man' Taiwo Oyedele as Finance minister

Wia dis foto come from, Taiwo Oyedele/X
Nigeria President Bola Tinubu don nominate di chairman of di Presidential Fiscal Policy and Tax Reforms Committee, Taiwo Oyedele as minister of state for Finance.
Oyedele go replace di former minister of state for finance, Dr Doris Uzoka-Anite wey don go anoda ministry.
For July 2023, President Tinubu appoint di tax expert, Oyedele, as di tax reforms committee chairman and by August 2023, dem inaugurate di committee to look ontop tax matters for Nigeria.
According to statement by President Tinubu media adviser, Bayo Onanuga on 3 March 2026, e say di president don forward Oga Oyedele name go di Senate for confamation.
"President Bola Tinubu nominate Mr Taiwo Oyedele as di minister of state for finance, to replace Dr Doris Uzoka-Anite. Oga Tinubu today convey di nomination of Oyedele to di Senate for confamation for letter to di Senate President, Godswill Akpabio, di statement tok.
Meanwhile di pesin wey dey occupy dat position bifor Uzoka-Anite go now move to di Ministry of Budget and National Planning, as di Minister of State.
Profile of Taiwo Oyedele
Bifor President Tinubu nominate Taiwo Oyedele as minister, e be di chairman of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms.
Oyedele na 50 years old from Ikaram-Akoko, Ondo State,
For im career, e be economist, accountant and public policy expert.
Oga Oyedele bin attend Yaba College of Technology, wia e get im Higher National Diploma (HND) for accountancy and finance.
E later go Oxford Brookes University wia e earned BSc for applied accounting.
Oyedele complete im executive education programmes for di London School of Economics, Yale University, di Gordon Institute of Business Science, and di Harvard Kennedy School.
Oga Oyedele don spen 22 years of im working career for PwC, afta e join dem for 2001 and rise to become di Fiscal Policy Partner and Africa Tax Leader.
Oyedele na professor for Babcock University wey dey Ogun State and also visiting scholar for di Lagos Business School.
E don appear for different conferences and summits wia e address tax matters.









