Wetin cause di South Sudan 'surprise' attack wey kill almost 200 pipo

A close-up of di body of gun wit magazine of bullets on top of am. Hand hold one part of di gun and you fit see more bullets.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Ruweng authorities tok say di attackers come for Sunday early mor-mor (file photo)
    • Author, Nichola Mandil
    • Reporting from, Juba, South Sudan
    • Author, Alfred Lasteck
    • Author, Jean Otalor
  • Read am in 3 mins

Di authorities for South Sudan tok say at least 169 pipo, wey include senior officials, bin kpai on Sunday wen one group of unkown gunmen start to attack one area for di north of di kontri.

Di Ruweng Administrative Area Infromation Minister James Monyluak Mijok describe di attack wey dozens of armed youth run say dem bin come from di neigbouring Unity state and get links to di Sudan People's Liberation Army in Opposition (SPLA-IO).

Di SPLA-IQ don deny say dia hand dey inside di mata as dem accuse di Unity state authorities say dem wan take politics finish dis kasala wey burst so.

Di UN don warn say e remain small make di kontri fall back to full scale civil war.

Mijok tok say "di pipo wey die for di attack include 90 pikin dem, women and elderly pipo plus incluuding 79 members of regional forces and police."

Di official add say 50 odas bin injure ofr di attack and now dey for Abyei Administrative Area, dey collect treatment.

Mijok tell di BBC say di attackers bin enta Abiemnom county for Ruweng bifor day break on Sunday by dat kain 04:30 local time (02:30 GMT) wen pipo still dey sleep and "surprise dem".

E say di govment forces on di ground "bin dey outnumbered... Di attackers bin set houses and markets on fire for di fighting wey last about three to four hours." Plenti senior local officials bin die wey include di county commissioner and executive director.

Mijok say govment forces don pursue di attackers comot since dat time and authorities don control di area fully.

E bin also allege say officials for Unity state "for don know" of di plan ot target Ruweng. But di Unity state authorities neva tok pim about di accusation. E no clear wetin cause di attack.

Di United Nations Mission for South Sudan (Unmiss) tok say like 1,000 civilians don start to dey find protection near dia base for di area. Dem say dem dey worry ova di rise of ksala in di region in di last 48 hours.

Anita Kiki Gbeho, wey be di officer in charge of Unmiss tok say "di mission don add to dia protective posture and dey work wit di gocment of South Sudan to support efforts to restore calm and guard di communities wey dey affected."

Dis kain tin don happun last year for Abiemnom county and dem kill 42 civillians.

Kasala wey burst between govment and opposition forces for anoda part of di kontri, Jonglei state don make di medical charity, MSF to miss 26 of dia staff and dme don suspend dia work for two parts of di state.

E dey of note to tok say, South Sudan wey be di youngest kontri for world don dey face civil war, poverty and corruption since dme form am for 2011.

Di UN don warn say "all-out civil war" fit come back as di power sharing deal wey President Salva Kiir and im long-time rival, Riek Machar sign for 2018 don dey scata all through di last year.