Nigeria Shia Muslims hold nationwide protests over death of Iran Supreme Leader

Group of Nigerians wey dey hold poster wey get picture of di Iran Ayatollah Ali Khamenei for 2014 protests

Wia dis foto come from, AMINU ABUBAKAR/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerians wey be Shia Muslims don dey do protests like dis one for 2014 no be today.
Read am in 3 mins

Members of di Nigeria Muslim communities hold marches on Sunday all ova northern Nigeria afta airstrikes kill Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei.

Im die for di first day of di US-Israeli war wit Iran.

Di protests hold for major cities for northern Nigeria wey include Abuja, Kaduna, Kano, Bauchi, Niger and Katsina, dis na according to statement wey comot from di the Islamic Movement in Nigeria (IMN) wey Sheikh Ibraheem Zakzaky dey lead.

Videos comot online wey show pipo dey carry di pictures of di late Khamenei as dem dey chant and pray.

Shia Muslims for Iran and oda places dey see di Supreme Leader as not only di political authority but also as some kain source of religious guidance.

Di Shia population of Muslims for Nigeria na minority as di kontri dey mostly made up of Sunni Muslims.

Di IMN start for di late 1970s and bin dey inspired by Iran Islamic Revolution. Dem also dey maintain dia religions and ideological ties wit Iran. So, na why wetin happun for Tehran dey affect dem like dis.

Di authorities say dem don dey torchlight di protests to make sure say wahala no go dey. Nigeria police bin announce increased security for di northern states as dem warn say, "any attempt to import outside ideological or religious wahala enta di kontri go face di full weight of di law."

Di IMN don get many kasala wit security forces sotay dem don detain dia leader, Zakzaky plenti times.

Di gorups say dem dey expect to run more protests on Friday to declare support for Iran and to mourn di death of di Supreme Leader.

Wetin be di difference between Sunni and Shia Muslims

All Muslims dey follow wetin dey written for di Quran but tension dey about who be di real successor of di Prophet Muhammed afta e bin die about 1400 years ago.

Na wetin create di two major branches of Islam, di Sunni and Shia.

Di Sunnis believe say na Abu-Bakr wey be di Prophet closest companion wen e still dey alive suppose be first Caliph (wey mean di deputy to God's prophet). Di name Sunni come from di sentence "Ahl al-Sunnah" wey mean "People of di tradition".

But di Shia wey be minority bin believe say Prophet Muhammed bin call im son-in-law Ali to lead di community. Even dia name reflect di belief as Shia mean "Party of Ali".

Tori don even comot say di divide don dey create wahala for id middle east for long and for Nigeria, dat one sef no too dey far from di truth.

For 2019, one Federal High Court for abuja say make di govment ban di followers of Sheik Ibrahim El-Zakzaky as terrorists.

But howeva, den president Muhammadu Buhari bin clarify say e no mean say Shia Muslims no go fit practice dia religion.