Trump say Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei die for US-Israeli strikes

US President Donald Trump don confam di death of Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, hours afta di US and Israel bin launch one large-scale attack on di kontri.
For one statement on im Truth Social on Saturday night, di American leader write say e die for di US-Israeli strikes on Iran.
"Khamenei, one of di most evil pipo for history, don die" E die for di US-Israeli strikes on Iran, e tok.
Oga Trump say dis na "justice" for "di pipo of Iran", Americans, and "pipo from many countries throughout di world"
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu bin earlier tok say dem don destroy Khamenei Tehran compound for inside "one powerful, surprise strike" and say plenty signs full ground say di 86-year-old cleric don "pass on".
Iranian authorities neva confam Khamenei death, and Iranian news agencies bin report say e tanda "strong and firm in commanding di field".
Iran bin respond to di attack wey US and Israel launch earlier on Saturday, as dem too launch missiles and drones towards Israel and four Gulf Arab countries wey dey host US military bases: Bahrain, Kuwait, Qatar and di UAE.
One social media video wey don go viral on X bin show as some Iranians for Karaj dey celebrate di reported death of di Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei – bifor even Donald Trump confam am.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Verify don confam three videos wey show celebrations for di cities of Karaj and Tehran.
One clip wey dem feem for one residential district near di city of Karaj, show as some group of residents dey dance and cheer for street, while cars sound dia horns.
For inside anoda video, one man dey shout "I dey dream, hello new world!" and pipo fit see as di crowd dey celebrate for di southern Fars province, as dem dey remove one sign of di founder of di Islamic Republic, Ayatollah Ruhollah Khomeini.
Khamenei, di hard-line cleric in charge of Iran since 1989
Ayatollah Ali Khamenei, wey be di supreme leader since 1989, na di most powerful figure in Iran.
E be di head of state and commander-in-chief.
E also get authority ova di national police and di morality police.
Khamenei dey control di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC), wey dey in charge of internal security, and im volunteer wing, di Basij Resistance Force - wey den use fight dissent for Iran.
Born in di north-eastern city of Mashhad in 1939, di son of a religious scholar, Ali Khamenei bin join di religious opposition movement of Ayatollah Khomeini against Shah Mohammad Reza Pahlavi for 1962.
Afta di Islamic Revolution for 1979, Ali Khamenei bin become di deputy defence minister and e help organise di Islamic Revolution Guard Corps (IRGC)
Afta di death of Khomeini for June 1989, di Assembly of Experts (one council of clerics) choose Ali Khamenei to be di new supreme leader, even though e neva achieve di rank wey dey required among Shia clerics as e take dey for constitution - marja-e taqlid (source of emulation) or grand ayatollah.
To correct di situation, dem amend di constitution to say di supreme leader gatz show "Islamic scholarship", wey enable Ali Khamenei to become ayatollah and be selected as supreme leader.
E maintain firm grip on Iran politics and dia armed forces, and e suppress challenges to di ruling system, sometimes violently.
Ayatollah Khamenei don also consistently take hard-line stances on external matters, wey include di ongoing confrontation wit di United States.
E bin remain suspicious of relations wit di West, particularly di US, and also e repeatedly call for di elimination of di State of Israel and e publicly question weda di Holocaust hapun.
Seven presidents of Iran don serve during di rule of Khamenei, wey get six children.











