United States and Israel launch attack against Iran

Wia dis foto come from, Hassan Abad Square
Israel don launch wetin dem call "pre-emptive attack" against Iran.
For inside one statement dis morning, Israeli Defence Minister Israel declare "special and permanent state of emergency" across Israel.
US President Donald Trump post one eight-minute video on im social media platform, Truth Social and confam say US dey involved for di attack on Iran.
Iran state-run rolling news channel IRINN, for one running caption confam reports of strikes on 28 February for Tehran, afta wetin Israel describe as "pre-emptive attack" against Iran
According to Iranian media, dem hear explosions for cities across Iran.
Di Fars news agency report say dem hear say explosions blast for di cities of Isfahan, Qom, Karaj, and Kermanshah.
Di news agency also report say several missiles hit University Street and di Republic area of the Iranian capital Tehran.
Trump say Iran dey develop missiles wey fit threaten Europe
For im statement on im Truth Social media platform, President Trump claim say Iran "attempt to rebuild dia nuclear program and to continue dey develop long range missiles wey now fit threaten our very good friends and allies for Europe, our troops stationed overseas and soon fit reach di American homeland."
E tok say di US dey undertake "massive" operation to "prevent dis very wicked radical dictatorship from threatening America".
"We go destroy dia missiles and burn dia missile industry to di ground. Nothing go remain again." Trump add.
Iran for long bin maintain say dia nuclear program na for civilian purposes only.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Dis na developing tori. We still dey update am!






