Israel announce 'tactical pause in military activity' for parts of Gaza

Aid trucks dey enta Gaza from Egypt

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Israel don announce one "tactical pause in military activity" for parts of Gaza afta dem deliver one aid air drop inside Gaza.

Di Israel Defense Forces (IDF) wey announce di informate for one statement, tok say "a local tactical pause in military activity go take place for humanitarian purposes from 10:00 to 20:00 starting today (Sunday)" for Gaza Strip.

E say "di pause go start for di areas wia di IDF no dey operate: al-Mawasi, Deir al-Balah, and Gaza City, every day until further notice.

"Di UN plus international organizations na dem coordinate dis decision following discussions on top di mata.

"In addition, dem go put designated secure routes in place permanently from 06:00 to 23:00 to enable di safe passage of UN and humanitarian aid organisation convoys wey dey deliver and distribute food and medicine give di population across di Gaza Strip."

Di IDF add say dem "go continue to support humanitarian efforts alongside ongoing manoeuvring and offensive operations against terrorist organisations for di Gaza Strip, in order to protect Israeli civilians."

Di IDF say dem dey prepared to expand di scale of dis activity as required.

Dis pause dey come afta Israel face mounting pressure from Western governments, wit aid agencies wey shout say mass starvation dey happun for Gaza

Wetin 'tactical pause' mean?

Di areas of di tactical pause across di Gaza strip

Wia dis foto come from, Israel Defense Forces

Israel announcement of a "tactical pause" in military operations in parts of Gaza today na significant development - but dis no be di first time e dey happun.

Earlier for di war, di Israeli military bin regularly announce "tactical pauses" for specific areas. These dey usually last for hours, not days, and dem dey often put am in place to allow UN humanitarian operations.

For example, for November 2024, during one mass polio vaccination campaign, di Israeli military tok say dem carry out "tactical humanitarian pauses in order to facilitate di distribution of di vaccines".

And for June 2024, Daniel Hagari, tok-tok pesin for di Israel Defense Forces (IDF), tok say dem allow one "tactical pause to make sure di international organisations go understand say we dey create safe pathway" for aid to enta Gaza.

Israel allow more aid to enta Gaza

Aid trucks enta Gaza from Egypt

Wia dis foto come from, Getty Images

Kontris wey include UAE, Jordan and Egypt don dey deliver aid now to Gaza by land and air, as Egypt aid don already dey cross di border

Di UN food programme bin sama warning last week say almost one in three pipo for di Gaza Strip dey go for days without food.

"Malnutrition dey rise wit 90,000 women and children in urgent need of treatment," di World Food Programme (WFP) bin tok for one statement.

Unrwa Commissioner-General Philippe Lazzarini say "more dan 100 pipo, majority of dem children, don reportedly die of hunger".

Harrowing pictures of children wey dey suffer from severe malnutrition dey come out from di territory.

However, Israel don deny say hunger crisis dey for Gaza and say dem wan counter di claim wey say dem deliberately dey starve Palestinians.

Di Israeli military tok say dia planes drop seven packages of aid into Gaza early dis morning, wey contain flour, sugar and canned food.

Air drops na spectacle – and critics bin warn say dem dey do am to ease political pressure on Israel dan relieve di hunger of Gaza two million Palestinians.

More importantly, Israel say dem go implement humanitarian corridors to enable di safe movement of UN convoys for Gaza.

International aid agencies don repeatedly tok say safe passage dey essential and Israeli troops dey endanger dia ability to distribute aid as dem dey attack convoys and di civilians wey crowd around dem.

'We need real solution': Gazans welcome aid plan but fear say e no go end di crisis

Women and children queue wit pots for dia hands for food for Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Residents of Gaza don cautiously welcomed reports of di temporary humanitarian pause to allow aid into di besieged enclave, but many say di relief must be di beginning of a broader, lasting solution to di deepening crisis.

Israel military tok say dem go open humanitarian corridors to allow convoys of food and medicine to enta, afta warnings of starvation and weeks of international pressure.

For months, Gaza population of more dan wo million don face extreme shortages of food, clean water, and basic medical supplies as bombardment and border closures don bring daily life to standstill.

"Of course I feel a bit of hope again but also worry say di starvation go continue once di pause end," Rasha Al-Sheikh Khalil, one 39-year-old mother-of-four for Gaza City.

"Dis no be just about quantity of food, na about quality," Neveen Saleh, one mother-of-six tok.

"We neva eat one single fresh fruit or vegetable in four months. Chicken no dey, no meat, no eggs. All we dey get na canned foods wey most time don expire and flour."

Hamas-run health ministry say dozens of pipo dey die from malnutrition. On Saturday, 26 July put di toll from di last few days at 125, including 85 children.