Trump fault Iran and Israel for 'violating' ceasefire

Wia dis foto come from, Getty Images
President Donald Trump tok say both Iran and Israel violate di ceasefire im announce.
Di president tok say e no dey happy wit Israeli for violating di ceasefire wey dem agree to while e insist say Iran no go ever rebuild dia nuclear capabilities.
"Israel as soon as we make di deal dem come out to drop bomb. I no dey happy wit Israel, wen I tok say una get 12 hours no be to drop everything from di first hour. I no dey happy wit Iran either," e tok.
"We get two kontri wey don dey fight wit each oda for so long and so hard, dem no know wetin dem dey do.
I no dey sure if dem do am intentionally," di president tok. "I no like di fact say Israel go out dis morning at all. And I go see if I fit stop am."
E tok say Iran "no go ever rebuild dia nuclear" capabilities and add say e no dey "happy wit Iran either".
Trump insist say ceasefire still dey intact
Moments afta Air Force One departed wit Donald Trump on board, di US president don post new update onTruth Social insisting say "di ceasefire dey in effect".
Trump write say "Israel no go attack Iran. All planes go turn around and head home, while doing friendly 'plane wave' to Iran.
"Nobody go dey hurt, di ceasefire dey in effect! Thank you for your attention to dis matta!"
Trump issue warning to Israel for im Truth Social platform. Im ask di kontri make dem no carry out di strikes.
Di US president write say: "ISRAEL. NO FIT DROP THOSE BOMBS. IF YOU DO AM NA MAJOR VIOLATION. BRING YOUR PILOTS HOME, NOW!", e write.
Israel accuse Iran of violating ceasefire
Meanwhile, Israel defence minister accbinuse Iran of violating di ceasefire, two hours after dem agree to di deal wey Donald Trump and Qatar arrange.
Israel Katz vow to "respond forcefully to Iran violation of di ceasefire with serious strikes against regime targets for di heart of Tehran".
Israel say dem identify missiles launched from Iran - Tehran don deny launching any missiles, according to im state TV.
Dis dey come afta US President Donald Trump bin announce say ceasefire between Israel and Iran now "don dey in effect" and tell both countries: "Please no violate am!".
Several hours after Trump announcement, di Israeli government also confam am and agree to di ceasefire, and warn say dem go "respond forcefully to any violation".
Iran earlier bin say dem go only stop dia attacks if Israel do di same.
Dis dey hapun after Iran launch missiles for US airbase in response to strikes on im nuclear sites over di weekend - Qatar say dem stop all di missiles.
Iran state TV news channel IRINN say ceasefire don dey "imposed" on Israel following di "successful" Iranian attack on di US base for Qatar.
State TV tok for statement say Trump "beg" for a ceasefire afta Iran attack. Presenter read di statement loud.
Di statement also hail Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) and di Army and praise di "resistance" of Iranians.
IDF go 'respond wit force' to Iran, military chief of staff tok
Di chief of di general staff of di Israel Defense Forces (IDF) tok say di military go "respond wit force".
"In light of di severe violation of di ceasefire wey dem carry out by di Iranian regime, we go respond wit force," IDF post on X.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we know about di Iran-Israel ceasefire

Wia dis foto come from, The White House
- Na just afta 23:00 BST yesterday, Donald Trump announce say Iran and Israel don agree to ceasefire
- By 06:08 BST, Trump officially declare say di ceasefire dey in effect
- Around 07:10 BST, Israel say dem don agree to di US ceasefire proposal
- Iran bin say dem go stop attacking if Israel do di same last night
- Before di ceasefire take effect, both countries exchange heavy fire overnight
- E never still clear how many die or injure for Iran, but Tehran don get one of im worst nights, according to our reporter
- Israel say at least four people die and 22 injure for di southern town of Beersheba

Wia dis foto come from, EPA
More from Israel statement on di ceasefire
Di Israeli government bin say dem agree to di ceasefire proposal after "dem achieve di objectives" of im attacks on Iran.
According to di statement, Israel don remove Iran "dual immediate existential threat" from nuclear weapons and ballistic missiles.
E also say Israel don "inflicted serious damage on di military leadership, and destroy dozens of central Iranian government targets".
Di statement go on to say Israeli forces, in di last day, don "seriously strike government targets in di heart of Tehran, eliminating hundreds of Basij operatives" – one militia wey di Iranian government dey often use to suppress protests – and "eliminate anoda senior nuclear scientist".
"Israel thank President Trump and di United States for dia support in defence and dia participation in eliminating di Iranian nuclear threat," di statement add.
Statement from Iran
Iran Supreme National Security Council also release statement about "imposing di end of di war" on Israel and im "terrorist supporters".
Di Council warn say "any further aggression go dey met with a decisive, firm, and timely response by Iran".
Inside di statement, di Council praise di Iranian pipo for dia "awareness, resilience and unity", saying di "enemy's defeat" dey down to Iranians' "firm resolve, strategic patience, and refusal to accept humiliation or one-sided compromise".
Di statement also commend Iran and im forces for delivering "decisive and calculated blows" in retaliation for attacks on Iran.
Meanwhile, Qatar don send letter to di UN secretary general to condemn di Iran attack wey target di US-run Al-Udeid air base on Monday.
For one statement, Qatar Ministry of Foreign Affairs tok say di letter describe di attack as "extremely dangerous escalation wey represent violation" of Qatar "sovereignty and territorial integrity".
Di letter also tok say di Iranian Revolutionary Guard Corps missile attack fit cause "direct threat to regional peace and security".
Meanwhile, Iran foreign ministry tok-tok pesin on Monday tok say di attack on US-run Al Udeid military base "no get anything to do" wit Qatar.
Dis na Qatar base, but Esmail Baqai say Iran actions na "act of self-defence".
"Iran remain fully committed to good-neighbourliness policy wit respect to di state of Qatar and oda neighbouring kontris," Baghaei post on X.










