Iran launch missiles for US bases for Qatar and Iraq in response to strikes

Wia dis foto come from, Reuters
Iran don launch missiles for US airbases for Qatar and Iraq in response to strikes on dia nuclear sites on Saturday, 21 June, Iranian state media report.
Di state-run media announce say Iran don begin dia "mighty and victorious" response to US strikes.
Di state-run Tasnim agency tok say Iran Revolutionary Guard launch missiles for one US base for Qatar.
In di last few minutes, reports don full ground of explosions for di US-run Coalition Air Operations Centre for Al Udeid for Qatar.
One senior US official tell BBC say di White House and di Department of Defense dey aware, and dem dey closely monitor, potential threats to Al Udeid Air Base for Qatar.
For statement, Iran Islamic Revolutionary Guard Corp say Iran message to di White House plus dia allies dey "clear and explicit".
"[Iran] no go leave any attack on dia territorial integrity, sovereignty, and national security unanswered under any circumstances," di IRGC tok for statement wey dia state-owned media report.
Meanwhile, Qatar goment "strongly condemn" di attack on di al-Udeid Air Base.
Majed al-Ansari, official tok-tok pesin for di Ministry of Foreign Affairs, post on X: "We consider dis as flagrant violation of di sovereignty of di State of Qatar, im airspace, international law, and di United Nations charter."
E say Qatar air defence systems "successfully stop di attack and intercept di Iranian missiles" and dem bin don evacuate pipo from di base earlier.
E add say dem take all necessary steps to ensure di safety of personnel for di base, including Qatari Armed Forces members, friendly forces, and oda.
"We confam say no injuries or human casualties happun sake of di attack."
Di tok-tok pesin say Qatar get di right to respond "for manner wey dey equal to di nature and scale of dis brazen aggression".
Wetin you need to know about di Al Udeid base for Qatar
Al Udeid, wey dey located near Qatar capital Doha, dey serve as di headquarters for US Central Command air operations for di Middle East and e host nearly 8,000 US troops.
British forces also dey rotate through di base. Dem dey sometimes refer to am as Abu Nakhla Airport.
Di facility currently dey serve as di headquarters and logistics base for US operations for Iraq and e also include di longest air landing strip for di Gulf region.
Qatar give di United States access to di Al Udeid base for 2000. Afta di Americans take ova as base managers for 200.
Doha and Washington bin sign one agreement for December 2002 wey officially recognise di US military presence for Al Udeid facility, according to London-based intelligence firm Grey Dynamics.
For 2024, CNN bin report say US reach one agreement to extend dia military presence for Qatar for anoda 10 years.

Qatar close airspace as UK and US tell citizens to shelter in place
As di fight-fight still dey go on, Qatar don temporarily close dia airspace afta US and UK tell dia citizens say make dem shelter for one place "until further notice".
US embassy for Qatar bin suggest for one notice online say make Americans do am "out of abundance of caution".
UK goment say dem dey issue di in response to US alert.
Di warnings come afta di State Department tell US citizens for international locations to "exercise increased caution," afta US bomb three nuclear sites for Iran on Saturday. Iran bin threaten to retaliate.
For statement, Qatar Ministry of Foreign Affairs tok say di closure of dia airspace na to ensure di safety of residents and visitors.
For inside separate statement in response to di embassy notice, di foreign ministry say di warning "no necessarily reflect di existence of specific threats".
"Di security situation for di kontri dey stable," di statement tok, and add say "di relevant authorities dey closely monitor di situation and dem ready to take all necessary measures to ensure di safety of citizens, residents, and visitors".
Qatar na home to di largest US military base for di Middle East, Al Udeid Air Base. About 8,000 US citizens dey live there, according to di State Department.
E also be home to US CENTCOM headquarters for all dia air operations for di Middle East, where British military personnel dey also serve on rotation.
US get about 40,000 troops stationed for di Middle East.










