Afghanistan say dem go do dia own back afta Pakistan airstrikes kpai pipo

Afghan men search for victims after an overnight Pakistani air strike hit a residential area in the Girdi Kas village of Bihsud district, Nangarhar province on February 22, 2026.

Wia dis foto come from, Photo by Aimal Zahir/AFP via Getty Images

Read am in 3 mins

Afghanistan say dem go take appropriate and measured response at suitable time afta Pakistan carry out multiple overnight airstrikes on dem.

Di Taliban say di strikes kpai at least 18 pipo, including women and children.

Islamabad say di attacks bin target seven alleged militant camps and hideouts near di Pakistan-Afghanistan border and say dem bin launch dem afta recent suicide bombings for Pakistan.

Afghanistan condemn di attacks wey dem say bin target multiple civilian homes and one religious school.

Di fresh strikes dey come afta di two kontris bin agree to a fragile ceasefire for October following deadly cross-border clashes, though subsequent fighting don happun.

Di Taliban defence ministry say di strikes bin target civilian areas of Nangarhar and Paktika provinces and kpai dozens of pipo.

For Bihsud, Nangarhar, one man named Shahabuddin tell reporters while pointing to im destroyed house say out of 23 members of im family, na only five survive di attack.

Local Taliban tok-tok pesin Sayed Taib Hamd say 18 members of di family na im die.

Di BBC bin earlier receive info say na about 20 pipo don kpai.

No deaths don dey reported so far for oda areas wey di strikes hit.

Pakistan Ministry of Information and Broadcasting say dem don carry out "intelligence based selective targeting of seven terrorist camps and hideouts".

For one statement on X, dem say di targets include members of di banned Tehreek-i-Taliban Pakistan, wey di govment refer to as "Fitna al Khawarij," along wit dia affiliates and di Islamic State-Khorasan Province.

Di ministry describe di strikes as "a retributive response" to recent suicide bombings for Pakistan by terror groups wey dem say Kabul dey shelter.

Di recent attacks for Pakistan include one on a Shia mosque for di capital Islamabad earlier dis month, as well as odas wey happun since di holy month of Ramadan begin last week for di north-western Khyber Pakhtunkhwa province.

Pakistan bin accuse di Afghan Taliban of failing to take action against di militants, and add say dem get "conclusive evidence" say na militants bin carry out di attacks on di instructions of dia leadership for Afghanistan.

Di strikes dey come days afta Saudi Arabia bin chook mouth for di release of three Pakistani soldiers earlier dis week, wey bin dey captured for Kabul during border clashes last October.

Dose clashes bin end wit tentative ceasefire dat same month afta di worst fighting since di Taliban return to power for 2021.

Pakistan and Afghanistan dey share a 1,600-mile (2,574 km) mountainous border.