Wetin we know about hit-and-run accident wey kill engineer afta three hospitals deny am care for Ghana

Wia dis foto come from, SOCIALMEDIA
Authorities for Ghana dey investigate one hit-and-run accident wey lead to di death of one man for early February.
Di 29-year-old victim Charles Amissah die afta three big hospitals allegedly deny am emergency care afta di accident.
Tori be say di ambulance service carry di victim roam dis three hospitals – bifor e die.
Di hospitals allegedly deny am emergency care sake of dem say dem no get bed.
Di case trend on top social media wey pipo begin to call out di hospitals and di kontris healthcare system.
E neva be di first time pesin dey die in dis kind situation sake of dis no-bed syndrome for Ghana.
But dis latest case dey get di attention of di govment and oda agencies wey condemn di actions wey lead to di death of di victim.
Health ministry set-up three-member committee to investigate di case
Di kontri health ministry don set up three-member committee wey dey chook eye for dis mata.
Dem dey expected to submit dia report by 5 March 2026.
Inside one statement from di ministry, dem tok say "in response to di alleged denial of emergency care wey lead to di death of 29-year-old engineer Charles Amissah on 6 February, di committee go find di facts of di case."
"Dem also go examine di sequence of events, di decision-making process and oda tins wey lead to di delay and challenge for emergency care for di victim."
Di health ministry add say di committee go also chook eye for di protocols and policies around emergency care for pipo.
Di members of dis committee be:
- Professor Agyeman Badu Akosa – Pathologist (chairman)
- Dr Henry Kwasi Bulley – Ghana medical association rep
- Dr Koku Awoonor-Williams - technical advisor to di health minister
Apart from di health ministry, oda agencies like di health facilities regulatory agency (HeFRA) dey chook eye for dis case.

Wia dis foto come from, KORLEBU TEACHING HOSPITAL
Korlebu Hospital interdict four staff ova di case
Di Korlebu teaching hospital wey be di last place dem carry Charles Amissah go bifor he die ask four of dia staff to step aside.
Management of di hospital say two medical doctors and two nurses "dey interdicted following dia alleged failure to provide emergency medical care to di hit-and-run victim."
"In line wit administrative procedure, one committee dey investigate di unfortunate death of di victim," di statement from di hospital confam.
Dem also add say "pending di outcome of di committee, di board and management ask every pesin wey dey connected to dis case to cooperate wit di committee to ensure fair and transparent inquiry."
Some pipo say di no-bed syndrome be problem wit di healthcare system for di kontri for many years – wey authorities neva solve am.
Who be Charles Amissah and wetin happun
Charles Amissah be 29-year-old engineer wey bin dey work wit one food and beverage company – Promasidor Ghana.
Tori be say he bin dey ride one red bicycle dey go house afta work wen im dey involved for hit-and-run accident for road.
Di ambulance service reach di scene wey dem carry di victim wey dem begin to roam from one hospital to anoda until he die afta more than three hours.
State newspaper Daily graphic report say "di emergency medical technicians on top di ambulance control di bleeding wey dem apply cervical collar wey dem carry am inside di ambulance."
Di ambulance staff even offer to give dia hospitals dia trolly for dem to use to begin to give di patient proper care – but all di three hospitals no gree.
Na so di victim get cardiac arrest wey he die.
On Monday, staff of Promasidor Ghana organize vigil for dia late colleague.
Family of di 29-year-old say dem wan justice for dia son.
Ghanaian investigative journalist Manasseh Azure Awuni vex about di mata wey he write on top im social media page say "di billions of cedis wey politicians dey steal thru corruption fit provide beta healthcare and save lives."
"Today na Charles Amissah, tomorrow e fit be you. Take stand against corruption," im add.

Wia dis foto come from, NATIONAL AMBULANCE SERVICE
Odas condemn di three hospitals wey allegedly deny di victim emergency care, some too say di govment gat to fix di system wey get plenty wahala.
One global health strategist Dr Banda Khalifa say "di no-bed syndrome be symptom of poorly functioning emergency care system."
"Di bed be di final explanation wey di public dey hear, but di failure dey start much earlier," he tok for im social media page.
Im add say to survive for emergency dey depend of di full chain for dis system "di scene, transportation to di facility and di oda care, e neva be wetin dey happun for di entrance of di hospital alone."
"Ghana gatz stop dey tok about no-bed syndrome like ibi problem wit space – dat na public name of emergency system failure."









