One victim of Russian content creator wey dey film and release intimate videos of women for Ghana don tok to BBC

One of di women wey claim say say di Russian pick up artist contact am tok to BBC
Wetin we call dis foto, "Di man touch me even wen I reject am, I now begin to dey raise my voice in front of my pickins dat day"
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
    • Reporting from, Accra
  • Read am in 8 mins

One of di women wey di Russian 'pick-up artist' and vlogger – Vladislav Liulkov meet for Ghana don open up about her contact wit di content creator.

Di woman wey we hide her identity, tok BBC Pidgin say she reject di man wey govment confam say e be Russian, on 22 January 2026.

Viral pictures and videos dey trend on top social media of many women wey di Russian man Vladislav Liulkov film wen im visit di kontri and Kenya.

According to di kontri communication minister Samuel George, investigation by di cybersecurity authority show say Vladislav Liulkov "film intimate encounters wit some of di women wey e monetize di content for e online platforms."

Some of di victims wey get intimate encounter wit am already file formal complaint to di cybersecurity authority wey dey pursue di mata togeda wit di police CID and oda agencies.

Gender Minister Agness Naa Momo Lartey say dem dey provide psychological help for di pipo wey come forward.

But no be all di women wey Vladislav Liulkov allegedly film wit im smart glasses, "get sexual intercourse wit di Russian suspect," di Gender minister tok.

"But pipo dey shame dem on top social media; some of dem even dey suicidal."

In fact, some of dem wey im publish for im social media neva even follow am to his hotel or apartment serf.

Some of di women also reject am, like dis one (Juliet; no be her real name) wey open up to BBC Pidgin.

Ghana is pursuing the Russian citizen whose name has been given as Vladislav Luilkov
Wetin we call dis foto, Ghana govment dey offer psychological support for di victims; some of dem already file formal complaint wit di cybersecurity authority

'E still pursue me afta I reject am; I even raise my voice in front of my pickins dat day'

'Juliet' explain say di man stop am outside di mall wen she carry her pickins go dia to relax.

"He stop me wey he tok say I be beautiful; at first I bin tink say sake of my pickins, di kids be beautiful well well. But di man continue say im wan make we sabi each oda wey we fit marry if tins work out," she tok BBC Pidgin.

'Juliet' say at first she tink say di man bin dey joke wit her.

"So as im dey tok, I still dey waka to di taxi rank wit my pickins sake of dem tok me say dem want chop sometin else so I bin dey try to move to anoda location."

"Di man pursue us till we reach di car wey he tok me say he want make I come see his place, so I no go tink say he be bad pesin; na so I begin to raise my voice dey ask am how I fit follow am to im house di same day I dey meet am; wey I sabi say he be foreigner so he go dey for hotel," Juliet continue to narrate di tori.

For many of di short videos wey Vladislav Liulkov bin post on top im social media, di pick-up line be "Wetin be your name; you be fine pesin - follow me."

According to 'Juliet', di man now begin to dey touch her body.

"I already vex at di way he dey tok say make I follow am to im hotel, by dis time he now dey touch me, even when I bin stop taxi to carry me and my pickins comot dat place."

She explain say "di taxi driver even begin dey ask me wetin dey happun, wey I tok am for our local language say I neva sabi wetin dey wrong dis oyibo man; di taxi driver say make I no mind am."

"I begin to raise my voice, di pickins now dey watch me wey Vladislav Liulkov kontinu to dey hold my shoulder, dat be how I shake wey my mobile phone even fall for ground."

"No be say I wan throway di phone but di way di man bin dey pursue me make I vex; di taxi driver now tok am say make e stop wetin e dey do; e make I bin dey aggressive in front of my pickins."

'Juliet' tok BBC pidgin say dat be how di taxi driver make sure she enta di car wey dem move from di place, until she begin to hear say dis Russian man bin film many women when e visit di kontri.

"Dat be how I now remember say na di same man I bin meet dat day, imagine say I bin follow am, just imagine."

How she dey feel about di pictures and videos of oda women on top social media?

Di kontri communication minister don warn pipo say to dey share dis images and videos of di victims, na crime under di cybersecurity act.

'Juliet' say she feel somehow when she begin dey see di pictures and videos of di oda women online, especially di ones wey Vladislav Liulkov carry di women enta e room.

"I bin feel bad when di images comot; I now dey tink say e fit be me wey my pictures go dey everywia if I follow am dat day; no be say I dey proud of wetin di women do, but sometimes pipo gatz to calm down."

She also tok say Vladislav Liulkov don edit many of di videos wey dey show say di women don follow am di moment im meet dem.

"Di videos I see online na cut-and-join, dat be why pipo bin dey tink say e just tok say follow me, wey dem all follow am. Dat no be wetin happun. Im cut wetin im wan use for di content."

"For di pipo wey dey bash di women, every pesin fit make mistake, na human being we be, but make pipo relax for my sisters, if I bin dey inside di video, I fit stand am, sake of I be strong pesin, but odas no dey di same, dem no fit face am; dem fit even kill diaserf."

The country's communication minister is hinting there could be prosecution in absentia

Wia dis foto come from, GHANA GENDER MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana govment say dem dey escalate di case to involve interpol make dem issue international arrest warrant so dem fit gbab am anywhere outside Russia

"I go dey happy if govment fit make dis man face di law"

Russian no dey extradite dia citizens to oda kontris when dem commit crime outside di kontri.

Na so dem also no dey prosecute dia citizens wey commit crime for oda kontris, according to di dia law; wey Ghana communication minister Samuel George and di Gender minister Agnes Lartey confam, afta dia meeting wit di Russian ambassador for Ghana – Sergei Berdnikov ova di mata.

Di communication minister confam for press conference say "di police togeda wit di cybersecurity authority go escalate di mata for Interpol to issue international arrest warrant for di man."

Dis go make dem gbab am anywia outside Russia when dem find am.

Di minister also tok say di cybersecurity authority wey bin dey chook eye for dis case, dey prepare to prosecute di suspect in absentia.

'Juliet' tok BBC Pidgin say na good news if di govment fit get justice for di victims.

"Dis man do plenti tins wit dis women wey e record dem without dia consent; na bad tin. Di govment gatz to do sometin about dis mata."

Some of di victims dey suicidal

One pesin wey im friend be victim tok BBC Pidgin say "she dey very suicidal; she no fit comot her house serf. E dey break my heart."

"She bin dey need all di help she fit get now; di tin dey break me as well," he tok dis reporter.

BBC Pidgin refer am say make dem contact di gender ministry wey dey provide psychological and counselling service to di victims.

Ghana gender minister Agnes Naa Momo Lartey call for empathy for di victims as her ministry continue to provide dis support to dem.

'Juliet' wan make all di victims to get therapy, make dem no listen wetin pipo go dey tok.

"I go advise di women wey dey affected say make dem get support. Dem dey need dis care and therapy - pipo wey dey judge dem fit dey do worse tins for dia closet, but dem dey social media dey drag dem; e neva be good tin."

She say, "dis one too go pass, make dem take lesson from dis experience but make dem get di help dem dey need to move on."

Plenty tori bin dey on top social media say Vladislav Liulkov bin visit Kenya and oda kontris wey e do di same tins for dia.

"I go tok any pesin wey get intimate wit am to check diaserf for hospital for any disease; di first tin wey enta my mind when I begin to dey see di videos online be say dis man fit get some sickness wey e wan share for pipo," 'Juliet' explain.

Juliet wants the victims who had intimate encounters with him to get tested
Wetin we call dis foto, "I go advise di women wey dey affected say make dem get support - pipo wey dey judge dem dey do worse tins for dia closet

She add say "I neva fit tink about any reason why pesin go comot dia kontri and visit oda kontris to sleep wit women for those kontris – e neva go make sense to me."

Ghana authorities say dem dey "trace di digital and financial evidence" of di intimate content wey Vladislav Liulkov don publish for im paid platforms.

For now, di Russian embassy say dem go cooperate wit Ghana authorities for dis case at dia own level.

E neva dey clear wey kind cooperation dem go provide but di kontris ministers say dem go work wit di embassy togeda wit di oda agencies.

Ghana's cybersecurity act, 2020 (Act 1038) dey prohibit di non-consensual recording and sharing of intimate images.

Pesin wey dey guilty fit face up to 25 years for prison, according to di level of di crime under di cybersecurity act.