Ghana authorities release picture, details of 'pick-up artist' wey film and publish videos of women

Dem accuse di man say e feem several women during sexual encounters, without their consent. (File picture)

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Ghana Minister for Communications Samuel Nartey George don release images of di Russian 'pick-up artist' wey film and publish intimate images of Ghanaian women.

Di kontri bin tok say dem go pursue di mata to make sure say di suspect face justice.

Ghana foreign minister invite di Russian ambassador Sergei Berdnikov ova di mata.

Tori don comot from di meeting say di "two kontris go work together to pursue di individual."

For one press conference on Wednesday 18 February for Accra, di Communications Minister publish di passport of di suspect wey get di name Vladislav Liukov.

Di latest development dey come afta tori first comot say di Russian Ambassador say e no fit confam if di suspect be Russian citizen.

Samuel George tok say "di Communication and Gender Ministries sabi who dis pesin be; we get di passport wey e take enta Ghana, we get e pictures; we go share am."

E tok say some victims file formal complaint wit di cybersecurity authority wey di police CID dey handle am.

"Di police togeda wit di cybersecurity authority go escalate di mata for Interpol to issues international arrest warrant for di man."

Di Minister also tok say di cybersecurity authority wey bin dey chook eye for dis case, dey prepare to prosecute di suspect in absentia, since Russia no dey extradite dia citizens to oda kontris, wey dem also no dey prosecute dem for crimes wey dem commit outside di kontri.

Pipo for di kontri don vex about dis mata wey dem tok say dem dey hope di kontri fit pursue di suspect; but oda pipo too dey blame di women say na dem bring dis for dia own head.

Ghana Gender Minister Agnes Naa Momo Lartey say "no be all di women wey get intimate wit di man; no be all of dem wey ger sexual intercourse wit di suspect."

She say "some of dis women dey suicidal especially those wey no get any sexual contact wit di suspect."

Agnes Naa Momo Lartey call for empathy for di victims as her ministry dey continue to provide counselling and psychological support to dem,

"Some of dis women dey traumatized by all di publications; sake of dem put all of dem togeda wey pipo dey shame dem."

She add say "we no go allow pipo to violate Ghanaian citizens and go scot-free."

Investigation by di cybersecurity authority show say di suspect film intimate encounters wit some of di women wey e monetize di content for online platforms.

Ghana authorities say dem dey "trace di digital and financial evidence linked to di case."

Ghana Cybersecurity Act, 2020 (Act 1038) prohibit di non-consensual recording and sharing of intimate images.

Pesin wey dey guilty fit face up to 25 years for prison, according to di level of di crime under di cybersecurity act.