Police detain son of Robert Mugabe for South Africa afta reported shooting

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty Images
- Author, Nobuhle Simelane
- Reporting from, Johannesburg
- Author, Damian Zane
- Read am in 3 mins
Police for South Africa don arrest di youngest son of Zimbabwe late former President Robert Mugabe.
Dem take 28-year-old Bellarmine Mugabe into custody following reports say dem shoot one 23 year man wey dem believe say be gardener.
Police dey describe di incident as case of attempted murder.
Dis dey come afta one reported shooting for one property for one upmarket suburb for Johannesburg.
Police currently dey di house wia di incident happun for Hyde Park, wia Mugabe dey stay, and dem dey find di firearm for inside wetin dem describe ascase of attempted murder.
Bellarmine Mugabe na di youngest son of Robert and im second wife Grace Mugabe.
Robert Mugabe wey die for 2019, lead Zimbabwe for 37 years bifor dem force am out of power for di age of 93 for 2017.
Two pipo dey for detention for questioning as di South African police dey investigate di circumstances of di shooting, police tok-tok pesin Col Dimakatso Nevhuhulwi tell BBC.
Police neva officially name Bellarmine Mugabe yet as one of di pipo dem arrest, but eyewitnesses for di scene see as dem handcuff and carry am comot. Also local media don report im arrest.
Di victim dey for hospital and for critical condition, di tok-tok pesin add.
For one briefing outside di property, Nevhuhulwi tok say di two suspects neva "tell us wia di gun dey, dem no dey tok anything about di gun".
Last year, court find anoda son of Robert Mugabe Jnr guilty say e dey in possession of cannabis for Zimbabwe and dem fine am.










