At least 203 pipo die for Lebanon afta Israel air strikes

Wia dis foto come from, Mohammad Abushama / Anadolu via Getty Images
- Author, Hugo Bachega
- Role, Middle East correspondent
- Reporting from, Beirut
- Read am in 5 mins
Lebanon health ministry say 203 pipo don die and more dan 1,000 don get injury within di last 24 hours across di kontri.
Israel carry out plenty air strikes across Lebanon on Wednesday, wey kill and wound hundreds of pipo, while officials say war against Lebanese armed group Hezbollah still dey kontinu despite ceasefire for Iran.
E come as Iran tok say ongoing Israeli strikes across di nation na "grave violation" of di US-Iran ceasefire agreement.
Rescue teams still dey search for one or two pipo wey dem believe say dey under rubble of one building wey collapse afta Israeli air strike hit am for Beirut.
Di latest escalation for di long-time conflict between Hezbollah and Israel start when di group fire rockets into Israel as retaliation for di killing of Iran supreme leader Ayatollah Ali Khamenei for di early stage of di war, and also in response to di near-daily Israeli attacks on Lebanon wey still dey happun despite ceasefire wey dem agree on for November 2024.
Dis attacks happun afta Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu office deny wetin Pakistan tok, say di ceasefire deal between US and Iran cover di conflict for Lebanon.
For Washington, US President Donald Trump press secretary Karoline Leavitt also tok say Lebanon no dey part of di deal.
Hezbollah, wey never claim any attack since di deal announcement, say dem get right to respond and warn displaced families make dem wait for formal ceasefire announcement before dem try return home.
More dan 1,700 pipo don die, including at least 130 children, so far sake of di war, Lebanon health ministry tok, witout separating fighters from civilians.
Israel say dem don kill about 1,100 Hezbollah fighters.

Wia dis foto come from, Adnan Abidi / Reuters
E hard to see wetin be Israel long-term strategy
Di morning afta Israel bombs bring destruction to dis city, Beirut quiet.
President Joseph Aoun describe am as "massacre", and govment announce say Thursday go be public holiday to mourn those wey die.
For about 10 minutes, around 14:00, di whole kontri come under attack.
Israeli military say dem carry out more dan 100 air strikes on wetin dem call Hezbollah targets. Busy, crowded residential areas get hit, and Israel know say dis one go lead to plenty casualties.
According to Lebanon health ministry, at least 182 pipo die, number wey fit increase, and 890 pipo get injury.
Even Israeli military officials accept wetin pipo for Lebanon don know for long, say Hezbollah no go drop weapons by force.
Di attacks fit give Israel some military gain, but e go likely small.
Meanwhile, pipo wey support and those wey oppose di group dey come togeda in anger and criticism of Israel, unite dia belief say wetin happun no acceptable and no get justification.
US 'must choose' between war and ceasefire, minister tok
For im interview wit Today programme, Iran deputy foreign minister tok say US "must choose" whether e want war or peace.
"Dem no fit get both at di same time. Dem no fit work togeda, e clear."
As we don report, Saeed Khatibzadeh say Israel ongoing strikes for Lebanon na "grave violation" of di US-Iran ceasefire.
Iran, he say, dey ask "evribodi for Middle East to follow dis agreement… and we expect Americans to do di same wit dia allies."
Wen dem ask am weda Iran go comot from negotiations if Israeli strikes kontinu, e say "We dey focus well well on di wellbeing of di whole Middle East."
On di oda hand Iran delegation dey go Pakistan today to start negotiations wit US on how to end di war, Iran ambassador don Pakistan confirm.
Dem go meet US Vice-President JD Vance for Islamabad on Saturday.
Reza Amiri Moghadam, Iran ambassador to Pakistan, post for X say di toks go base on 10 points wey Iran propose. As we don report, confusion still dey about wetin those points be.
Moghadam say di toks go happun "despite doubt from Iranian public bicos of repeated ceasefire violations by Israeli regime to spoil di diplomatic process."
Oil prices dey rise small as ceasefire concern grow
Oil prices don rise small and financial markets still dey tense as concern dey grow whether US-Iran ceasefire go hold and whether Strait of Hormuz shipping route go open.
After e fall on Wednesday immediately afta ceasefire announcement, Brent crude oil price rise 2.7% on Thursday reach $97.23 per barrel.
Stock markets for Asia fall back, reverse some of di big increases wey dem see yesterday. Japan Nikkei close down 0.7% while South Korea Kopsi index fall 1.6%.
For Europe, UK FTSE 100 index fall 0.1% shortly after opening and markets for Germany and France also go down.
"I tink say small nervousness dey for global markets," Victoria Scholar, head of investment for Interactive Investor, tell BBC Today programme.
"Markets dey lose some gains… and I tink say e show plenty uncertainty whether Strait of Hormuz really open."










