'Nigeria na di deadliest place to be Christian' - US Congress report find

Three women siddon for di front of one burnt church

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 6 mins

"Nigeria na di deadliest place in di world to be a Christian," US Congressmen report find.

Di report wey US lawmaker Riley Moore and di House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit to di White House on Monday, 23 February, discover say Christians dey suffer violent attacks for di hands of well-armed Fulani militias and terrorist groups, wey don lead to di death and murder of tens of thousands of Christians, wey include pastors and priests.

Di report add say thousands of Churches and schools dey destroyed, kidnappings also dey go on.

According to di report findings, blasphemy laws dey for Nigeria northern states wey dem take to silence speech, target Christians plus minorities and justify so called "convictions" without due process.

Congressman Moore bin confam di presentation of di report to di White House for one post on im X official account on.

"Dis comprehensive report outline concrete actions to end di persecution of Christians for Nigeria and counter growing extremist violence for di region," e add.

Di US House Committee on Foreign Affairs also say di report show di "unrelenting plight Christians don face for years for Nigeria."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Dis report dey come afta claims of genocide against Nigeria Christians begin circulate last year for some right-wing US circles.

President Trump last year bin ask Congressman Moore and Appropriations Committee Chairman Tom Cole to lead investigation on di persecution against Christian communities and security challenges wey dey border Nigeria afta tori of dia persecution begin spread.

"Dis report na di result of months of investigation, wey include a bipartisan congressional fact-finding trip to Nigeria, hearings wit expert witnesses, consultations wit religious leaders, meetings wit Internally Displaced Persons, and engagement wit senior Nigerian govment officials," Lawmaker Moore tok.

Also for October 2025, US President Donald Trump also declare Nigeria as a "Country of Particular Concern"

Inside one post on im Truth Social, Trump say Christians for Nigeria dey face threat and e accuse di govment say dem fail to protect Christians from jihadist attacks.

However, Nigeria bin reject di claims of "Christian genocide," di govment say violence start from terrorism and land disputes, no be religion. Dem add say na both Christians and Muslims don suffer attacks.

Some organisations wey dey monitor political violence for Nigeria say most victims of di jihadist groups na Muslims.

But some Christian leaders however say instances dey wia Christians dey specifically targeted.

Recommendations from di report

Di report outlines several recommendations, some of dem appear to already dey operational - di offering of Technical assistance to help Nigeria disarm violent militias and strengthen security‑force capability, appear to be in progress wit di recent deployment of US troops to Nigeria.

Speaking afta di White House briefing, Congressman Moore say: "Our brothers and sisters in Christ don suffer in silence for too long… Di world now dey watch, and I urge di Nigerian government to take dis opportunity to deepen and strengthen dia relationship wit di United States."

E describe di recommendations as a roadmap for accountability, coordinated counter terrorism, and long term stability, e insist say security for Christians and other vulnerable groups must now dey non negotiable.

Dis na some of di recommendations:

  • Make Nigerian govment cancel Sharia and blasphemy laws.
  • Establish bilateral US-Nigeria security agreement to protect vulnerable Christian communities, eliminate jihadists activities for di region.
  • Remove Fulani militias from confiscated farmlands and enable di voluntary return of displaced communities to dia homes.
  • Implement sanctions and visa restrictions against individuals and groups wey dey responsible for or get hand for religious persecution.
  • Withhold certain U.S. funds, pending demonstrable action by di Nigerian govment to stop violence against Christians.
  • Continue visa restrictions for perpetrators involved in Christian violence and violations of religious freedom.
  • Review and use points of leverage to compel Fulani herdsmen to disarm, wey include by blocking di export of beef, plus oda cattle related products to countries like Ivory Coast, Ghana, South Africa and Senegal.
  • Oda recommendations include Coordinating efforts wit international partners like France, Hungary and di UK.

If implemented, di recommendations go mark one of di most assertive US interventions for Nigeria internal security landscape for decades.

Di report emphasize say protecting religious freedom dey central no be only to humanitarian concerns but also to regional stability and US strategic interests.

Nigerian govment neva react to di recommendations yet. But these remain di defining next test, weda Abuja embrace di proposals - and weda conditions improve for communities wey for long dey caught between extremist violence and state inaction.

President Bola Tinubu to establish State Police

President Tinubu tanda wit some state govnors

Wia dis foto come from, Presidency/X

Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu don announce say im govment dey plan to establish state police forces as part of efforts to tackle growing insecurity across di kontri.

E announce di informate on Tuesday, during one Ramadan Iftar wit state govnors.

Di announcement come di same day US Congressmen submit di report of dia findings and recommendations on di alleged persecution of Christians for Nigeria to di White House.

Di Nigerian leader say di move dey driven by practical needs and reforms, rather dan political motivations.

"I dey determined to rescue dis kontri and as long as we work togeda in delivering hope to our citizens, di best is yet to come for Nigeria," e tok.

"We go establish state police to curb insecurity. Dis no be about politics. Na about practicality. Na about empowering states wit di to protect dia people while strengthening our national framework," e add.

"Security na di foundation of prosperity. Without it, farms no fit flourish, businesses no fit grow, and families no go fit sleep in peace."

State govnors for long don advocate for state police. Dem argue say local law enforcement units wit constitutional authority go dey better equipped to address security challenges wey dey tailored to dia specific regions.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

E also use di occasion to challenge di state govnors to do more for dia citizens and ensure say dem feel di positive impact of di administration, especially during dis season of Lent and Ramadan.

"To reach di young man wey feel forgotten. To lift di woman wey carry her family on tired shoulders. To touch di communities for di grassroots wia hope sometimes no certain.

"Development must not recognise religion. Compassion must not recognise tribe. Opportunity must not recognise status," President Tinubu tok.