El-Rufai sue ICPC for unlawful invasion of im home, demand N300m for psychological trauma

Foto of El-Rufai

Wia dis foto come from, Nasir El-Rufai/Facebook

Read am in 3 mins

Former Kaduna State Govnor, Malam Nasir El-Rufai, don file N1 billion fundamental rights enforcement case against di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) and odas, ova di alleged illegal invasion of im Abuja residence.

El-Rufai, through im legal team lawyers file di charges wey dey marked FHC/ABJ/CS/345/2026 bifor di Federal High Court, Abuja

For di originating motion wey El-Rufai lawyer, Oluwole Iyamu file on im behalf, di former govnor sue ICPC, di Chief Magistrate, Magistrate Court of di FCT, Abuja Magisterial District; di Inspector-General of Police and di Attorney-General of di Federation (AGF).

El-Rufai dey ask di court make dem declare di search warrant wey di chief magistrate issue on 4 February authorising di search of im residence for im house House for Aso Drive, Abuja null and void.

Di legal team ask di court make dem declare di search warrant "null and void for lack of specificity in describing items wey dem go seize, typographical errors, ambiguity in execution parameters, and absence of probable cause thereby constituting unlawful and unreasonable search wey violate Section 37 of di constitution.

El-Rufai ask di court make dem also declare say di invasion and search of im house for Aso Drive, Abuja, on February 19 around 2 p.m., wey ICPC and di IG carry out, "under di invalid warrant, amount to gross violation of di applicant fundamental rights to dignity, personal liberty, fair hearing, and privacy under Sections 34, 35, 36, and 37 of di constitution. "

For di suit, El-Rufai allege say di agency seize personal items, including documents and electronic devices (wey dem list as Exhibit B for di supporting affidavit), wey dem neva return back.

El-Rufai dey ask di court make di1st and 3rd respondents (ICPC and IG) return all di items wey dem seize from im house during di search.

E tok say make dem award am1 billion naira in damages for di violation of im fundamental rights, unlawful seizure, infringement of privacy, among odas.

El-Rufai breakdown di 1 billion naira wey im dey demand in damages as:

300 million naira compensation for psychological trauma, 400 million naira exemplary to make sure law enforcement agents no misbehave again, and 300 million naira na for aggravated damages for di malicious and oppressive way wey dem take act and 100 naira million na for for legal costs

On Wednesday, ICPC bin arrest Mr El-Rufai afta e comot from EFCC custody for Abuja. El-Rufai tok-tok pesin, Muyiwa Adekeye and ICPC bin confam di arrest of di former govnor ontoip X.

Di Department of States Services (DSS) don also file three charges aganist El-Rufai for di federal high court for Abuja.

Dis na afta, one interview wia El-Rufai claim say im intercept Nuhu Ribadu, di chairman of National Security Adviser phone call.

During di interview, El-Rufai claim say na Nuhu order im attempted arrest for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja, on 12 February.

Inside anoda letter, El-Rufai bin claim say NSA import Thallium sulphate into di kontri.

All dis allegations na im NSA don deny but dem don dey investigate di former govnor.

Dem go arraign am for federal high court for Abuja on Wednesday 25 February ova di phone interception mata.