Nigeria govment file three count charges against Nasir El-Rufai - wetin dem be?

Embattled former Kaduna govnor Nasir El'Rufai dey laugh. E wear green traditional cap and agbada.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 6 mins

Nigeria govment don file three count charges against one former govnor of Kaduna State, Nasir El-Rufai.

Nigeria govment through di Department of States Services bin file di charges wey dey marked FHC/ABJ/CR/99/2026 bifor di Federal High Court, Abuja Judicial Division.

According to di charge sheet wey tori pipo see on Monday, di govment claim say di former govnor admit say im and im associates allegedly intercept di Nigeria National Security Adviser (NSA), Nuhu Ribadu phone conversations.

Di charge wey dem file list di Federal Republic of Nigeria as di complainant and Mallam Nasir El-Rufai as di defendant.

From di charge sheet, di prosecution claim say on February 13, 2026, wen e appear as guest on Arise TV Prime Time programme for Abuja, El-Rufai bin admit say im and odas unlawfully intercept di phone communications of di NSA.

Di embattled former govnor neva react to di three count charges di govment sama am.

Count 1

Say you, Mallam Nasir El Rufai, adult, male, on 13th February, 2026, wen you appear as a guest on Arise TV Station Prime Time Programme for Abuja, within di jurisdiction of dis court, you admit during di interview say you and your cohorts unlawfully intercept di phone communications of di National Security Adviser, Nuhu Ribadu and thereby commit offence contrary to and punishable under Section 12 (1) of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc) Amendment Act, 2024.

Count 2

Say you, Mallam Nasir El Rufai, adult, male, on 13th February, 2026, wen you appear as a guest on Arise TV Station Prime Time Programme for Abuja, within di jurisdiction of dis court, tok during di interview say you know and relate wit certain individual, wey unlawfully intercept di phone communications of di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, witout reporting di said individual to relevant Security agencies and thereby commit offence contrary to and punishable under Section 27 (b) of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc) Amendment Act, 2024.

Count 3

Say you, Mallam Nasir El Rufai, adult, male, plus odas still at large, sometime in 2026, for Abuja, within di jurisdiction of dis court, use technical equipment or systems wey compromise public safety, national security and wey put reasonable apprehension of insecurity among Nigerians by unlawfully intercepting di phone communications of di NSA, and you confam am during one interview on 13th February, 2026, on Arise TV Station Prime Time Programme for Abuja and thereby commit offence contrary to and punishable under Section 131 (2) Nigerian Communications Act 2003.

Security fire teargas to scata El-Rufai supporters wey follow am go report to EFCC

Supporters of former Kaduna State Go
vnor Nasir El-Rufai dey protest for di headquarters of di EFCC on Monday, 16 February, 2026

Wia dis foto come from, TheICIR/X

Wetin we call dis foto, Supporters of former Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai dey protest for di headquarters of di EFCC on Monday, 16 February, 2026

Meanwhile, security operatives bin use teargas to scata supporters of El-Rufai wey land di headquarters of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for Abuja to ansa di invitation wey di anti-corruption agency send am.

Some of im supporters follow am go to di EFCC office but operatives of di commission no allow make dem enta inside dia premises.

Small protest bin break out as di EFCC use teargas to pursue El-Rufai supporters as some of dem wan use force follow am enta.

Video by some tori pipo wey dey ground for dia show as some of di former govnors supporters dey shout say "we go come back" as smoke from di teargas full evriwia.

Oda supporters of El-Rufai carry placards wey dem write "El-Rufai na citizen, no be subject", "we stand wit El-Rufai, we stand for law", etc.

One of di El-Rufai supporters tell tori pipo say dia anger na bicos e get some group of pipo wey dey against El-Rufai, wey di EFCC bin allow make dem reach close to dia gate as dem dey insult am, but dem wey be im supporters no dey allowed to come close.

As e be now, di former govnor don dey inside di EFCC headquarters.

Anti-El-Rufai protesters gather for di EFCC headquarters to call for di arrest of di former govnor. 16 February, 2026

Wia dis foto come from, TheICIR/X

Wetin we call dis foto, Some anti-El-Rufai protesters also gada for di EFCC headquarters dis Monday dey call for di arrest of di former guvnor.

How di mata take start?

El-Rufai bin don tok for one interview wit Arise TV say di EFCC bin don write am letter of invitation wen e bin dey out of di kontri, and e bin promise dem say e go come honour di invitation wen e come back.

But bifor dat interview, El-Rufai bin don allege say im know say di govment of di day dey look for way to arrest am.

"Dem don arrest four of my pipo wey follow me work wen I be govnor of Kaduna State, so I know say na me be di next, and I dey wait for am," e tok for interview wit BBC News Hausa.

Dis Monday incident dey come just some days afta El-Rufai bin tell di BBC for interview say some men from di Department of State Service (DSS) bin wan arrest am for di Abuja Airport as e come back from Egypt last week.

E tok say e refuse to follow dem sake of say dem no get any warrant or any letter of invitation.

Di former govnor also reveal say na im supporters for di airport bin rally round to prevent di DSS from arresting im by force. E tok say na di Independent Corrupt Practices and oda related offences Commission (ICPC) bin recruit di DSS to "abduct am".

For anoda interview, El-Rufai tok say na di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, na im give di oda make di DSS arrest am.

Di office of di NSA neva tok anytin about dis incident.

Days later, El-Rufai write letter to di office of di NSA, and also post di letter for im X handle, wia e allege say di NSA office import 10 kilograms of one deadly poison wey di name na Thallium Sulphate into Nigeria.

For dat letter, di former govnor ask di NSA to explain to di Nigerian public why dem import di chemical and wetin dem wan take am do.

Di NSA office don deny say dem import any chemical like dat and say dem don refer di letter wey El-Rufai write to di DSS for investigation. Dem ask El-Rufai to produce proof of di importation of di chemical to di DSS to help dem wit dia investigation.