'Dem snatch im international passport' - Security agents attempt to arrest El-Rufai for airport

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP via Getty Images
Di former Kaduna State Govnor, Nasir El-Rufai, don confam say security agents bin attempt to arrest am wen e bin arrive Abuja airport from Egypt, but im no gree for dem.
According to Muyiwa Adekeye, wey be di Media Adviser to El-Rufai, e say im oga no gree follow di security agents wey wan arrest am sake of say dem no get any invitation.
"Security agents today attempt to arrest Malam Nasir El-Rufai as e arrive on flight from Cairo," di media aide tok.
Di kwanta hapun today 12 February 2026, as El-Rufai land for di airport. E don dey outside di kontri for sometime now and e just arrive afta some pipo wey dey close to am don hint say e go return to Nigeria dis week.
From di fotos wey El-Rufai media adviser put for X, e show wia di former Kaduna govnor bin dey for one place inside airport wia some security pipo gada.
Anoda video wey we see for social media bin show wia El-Rufai dey for di middle of im pipo wey come welcome am back to Nigeria.
Meanwhile, during di airport kwanta, El-Rufai aide say di security pipo collect im international passport.
Although, we neva receive any information on who di security agents wey bin wan arrest El-Rufai be, and no security operative for Nigeria don come out to tok wetin hapun.
"Malam El- Rufai no gree to follow dem without formal Invitation. Dem snatch im international passport from one aide."
For one video wey dey trend for di social media, El-Rufai dey challenge di security man wey stand in front of am.
Di security man wear yellow jacket dey follow El-Rufai tok say e get letter to pick am, but di former Kaduna govnor no gree, as im supporters wey dey around hail am.
"Nobodi, even di president no fit tell me say I gatz do sometin, na free kontri we dey. If you wan invite me, write letter," El-Rufai tok.
Recently. El-Rufai, bin don tok say im no get any personal relationship wit President Bola Tinubu.
El-Rufai yan dis one inside one interview wit Trust TV on Monday, wia e say im support Tinubu presidential ambition for 2023 becos of di party loyalty and political mata, and no be friendship.
"Assumption dey say I be Tinubu friend, but I no eva be im friend. We no get personal relationship like di one wey I get wit General Buhari," El-Rufai tok.
Di former govnor explain say im bin support Tinubu to become president becos leaders from All Progressives Congress and Islamic groups urge am to support di former Lagos State govnor,
Oga Tinubu bin nominate El-Rufai bifor as minister but gbege sup wey make di whole nomination no work out.
For March 2025, di former Kaduna State govnor El-Rufai, bin dump di All Progressives Congress (APC) to join di Social Democratic Party (SDP).
El-Rufai make di announcement wia e say di party no dey follow di original vision wey dem take form am for 2013.
Di former govnor, wey be one of di founding members of APC, say e don try raise concerns privately and publicly about di way wey di party dey move, but di pipo wey dey control APC now no send.
According to El-Rufai, e expect say im personal values and APC go align reach di time wey e wan retire from politics, but wetin e dey see no follow wetin e believe.
El-Rufai tok say e bin inform di former president late Muhammadu Buhari before e comot di ruling APC.
Howeva, tins take new turn wen El-Rufai bin comot di SDP to join new coalition party African Democratic Congress (ADC).
Di ADC political party come out as di anchor party for di opposition coalition to try to remove President Tinubu from office for di 2027 general election.
El-Rufai pick im ADC membership form for November 2025.
But tori about di reported attempt to arrest El-Rufai never clear yet.
Profile of Nasir El-Rufai
Nasiru El-Rufai na di immediate past govnor of Kaduna State from 2015 reach 2023.
El-Rufai first win im gubernatorial primaries for 2014 under di All Progressives Congress (APC).
Dem announce El-Rufai as di flagbearer for APC wia im defeat oda opponent for di 2015 govnorship election for Kaduna state. El-Rufai don serve as two-time minister of ministry of commerce.
Im bin serve as minister of federal capital territory (FCT) from July 2003 reach May 29, 2007 and don serve as director of di Bureau of Public Enterprises before.
El-Rufai attend Barewa college wia im graduate for 1976 bifor im proceed go Ahmadu Bello University for Zaria, wia im receive first class bachelor degree for quantity surveying.
Im later go Ahmadu Bello University again for 1984 wia im receive Master of Business Administration.
El-Rufai receive im law degree for di University of London for 2008, im study for masters degree in public administration for di John F. Kennedy School of Government of Harvard University in June 2009.
El-Rufai join di SDP for 2025 and still later join di ADC same year to form coalition to defeat Tinubu comot for office for 2027.










