How to protect yourself from fake investments - SEC

Trader dey analyse chart for im laptop and phone

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Di Securities and Exchange Commission don uncover anoda suspected illegal investment platform identify as Tofro.

Di commission raise di alert for one notice on dia website on Thursday as dem warn Nigerians against falling for dia tactics to obtain money from dem through di high promise returns.

SEC tok say di investment platform na cryptocurrency trading platform and e no dey registered wit dia commission.

SEC tok say Tofro dey operate like fraudulent Ponzi scheme platform, wit high returns, heavy reliance on referral system, and failure to honour withdrawal

"Di attention of di Securities and Exchange Commission don dey drawn to di activities of one online platform wey we sabi as Tofro, dem be cryptocurrency trading platform.

"Di commission hereby inform di public say di Tofro no dey registered by di commission either to solicit investments from di public or operate in any oda capacity within di Nigerian capital market."

Recently, ova 1.3 trillion naira sweep comot from CBEX investors accounts, one digital asset trading platform wey pipo bin dey invest dia money bifor e crash last month.

However, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don collaborate wit di International Criminal Police Organisation (Interpol) and di Federal Bureau of Investigation (FBI) to find pipo wey dey behind di CBEX platform.

So far, dem don declare 13 suspects wanted for allegedly perpetrating one fradulent online trading platform.

Plenti fall for di Ponzi scheme wey dey promise 100 percent return on investment for investors within one month.

How to know weda dat investment na fake/ponzi scheme

SEC for dia website www.sec.gov.ng don list out signs of scam, make Nigerians do dia due diligence on weda or not dis schemes dey registered and dem be real investment platform.

  • Any platform wey you dey pay money to get more money
  • Wia dem dey send you code from you phone, make you send give dem
  • Wia dem promise you instant wealth wit no effort
  • Deal wey dey sound too good to be true
  • You dey pressurise to act fast without time to tink about di investment
  • Wia dem dey make request of too many personal information.
  • Make you secret millionaire
  • Dem dey make free offer of gifts but you go need pay first
  • You go need register pipo bifor you fit get di prize you win
  • Unexpended inheritance from close relative wey you no dey aware about.
  • Guarantee profits wit no risk
  • Payment only via crypto
  • Shady-looking website
  • Di receiver no dey provide verifiable contact info or account details ? Scam.
  • Wen di platform dey too secretive and dem dey tell you make you no dey discuss di matter wit odas.
  • Experts wey dey tell you make you avoid legal means of investment.
  • Understand di nature of di investment bifor you put money
  • If dem no fit explain di business wey go bring di returns for di scheme
  • Check if di product or service di company dey sell dey genuine
  • Check weda di rate of returns dey sustainable.
  • Try dey avoid any investment wey you no understand and dem no fit explain give you like small pikin make you for understand.