EFCC collaborate wit Interpol, FBI on investigation ova CBEX Ponzi scheme

An eagle looking straight, wit FBI agent wearing a badge

Wia dis foto come from, EFCC/X/Getty Image

Read am in 4 mins

Afta several Nigerians don para say dem lose money ontop digital asset trading platform, CBEX, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don begin step to investigate di Ponzi scheme.

Di anti-graft agency tell BBC News Pidgin say dem dey collaborate wit di International Criminal Police Organisation (Interpol) and di Federal Bureau of Investigation (FBI) and odas to find dose wey dey behind di CBEX platform and how dem fit recover some money.

Dis na afta dose wey invest ontop di platform say dem bin no fit withdraw dia money for some days as withdrawal dey suspended, and suddenly, di platform crash wit many pipo losing dia money.

Tori be say na ova 1.3 trillion naira CBEX sweep comot from investors accounts.

Plenti pipo bin fall for di Ponzi scheme sake of say di CBEX investment bin promise 100 percent return on investment for investors in one month.

Wetin dem tink say go put smiles for dia faces na tears e put and di platform don run away wit pipo money.

Di head of media and publicity for EFCC Dele Oyewale tok say no be di first time be dis wey dem don dey work on investigating di platform bifor e finally crash.

"We dey work wit Interpol, FBI and oda international agencies sake of di jurisdiction. We dey work wit dem to dey able to uncover di entire fraudulent act and see how we fit remedy di situation," EFCC tok.

Di anti-graft agency add: "At least, to see how we fit recover some of di money wey pipo lose. As anti-corruption agency, we no fit keep quiet.

"We dey work bifor di platform collapse and we go kontinu to dey work."

CBEX na digital trading asset platform wey dey give investors 100% return on investment in 30 days, but di no be di first time wey Nigerians go dey fall into scam of di kain pattern.

Different investment ponzi schemes don enta Nigeria wia pipo bin put dia money and na tears, sorrow and pain end am as di platforms crash and carry dia money go.

Despite say di Securities and Exchange Commission (SEC) bin warn Nigerians against unregistered trading platforms, some still dey fall into di trap.

Trader is analyzing charts on his laptop and smartphone app, working remotely from his home office

Wia dis foto come from, Getty Images

Why Nigerians kontinu to fall for Ponzi schemes despite MMM and odas crash

Di number of Ponzi schemes for Nigeria now don turn anoda tin, e be like if pesin turn head like dis, anoda tin don suck millions from di pockets of kontri pipo.

E dey worry plenti pipo say ontop di numbers of Ponzi schemes wey don scam Nigerians, di pipo neva learn.

However, some sabi pipo dey link am to di economic situation of Nigeria and say Nigerians dey find beta options to make money.

Remember say for 2016 Mavrodi Mondial Moneybox aka MMM come wit promise of huge return if pipo put dia money into am.

For di small years wey MMM use for Nigeria bifor e crash, di Nigeria Electronic Fraud Forum record say kontri pipo lose about 12bn naira ($7million).

We ask sabi pipo why Nigerians still dey fall for Ponzi schemes.

Caleb Ijioma, wey be di executive director of Roundcheck wey dey chook mouth into fact-checking and literacy including financial literacy, e tok say as dis no be di first time wey pipo go fall into Ponzi schemes, na di benefits dey totori dem.

"Nigerians keep falling for dis Ponzi schemes becos of di benefits wey dem dey offer within a short period."

"You invest and get double of dat investment in a short time, dis na wetin make dis schemes dey attractive," Ijioma tok.

E add say dis "Ponzi schemes dey use pipo weaknesses and greed to force dem to invest dia money wit hope say dem go gain financial freedom".

According to dis sabi pipo, dose wey first enta di scheme dey collect money, and na dem dey promote di scheme to odas.

"Legitimate investment platforms no dey offer di same benefits as dis Ponzi schemes, and dis na why more Nigerians, regardless of past lessons dey fall for fake investment platforms."