Iran strike on Dubai and Abu Dhabi airport for Middle East kill one pesin and injure odas

Wetin we call dis Video, Video show debris across floor of damaged Dubai airport
    • Author, Tom Bennett
  • Read am in 5 mins

One pesin don die and 11 injure for airports for Dubai and Abu Dhabi, as Iran launch attacks across di Middle East in response to one big ongoing attack wey US and Israel carry out against am.

Authorities for Abu Dhabi confam say dem intercept one drone wey bin target Zayed International Airport (AUH), and e lead to "falling debris", wey kill one pesin and injure seven odas.

Dubai International Airport (DXB) - di world busiest by passenger traffic – dey affected for one "incident" wey injure four staff, according to authorities.

Authorities don pause thousands of flights to and from di region, inside one of di most serious disruptions to global travel since di Covid-19 pandemic.

All flights from Dubai International and Dubai Al Maktoum don dey suspended until further notice.

Di Emirates airline tok say dem don suspend all operations from Dubai until at least 15:00 local time on Monday, dem blame airspace closures for di closure.

While Etihad don suspend flights out of Abu Dhabi until 02:00 on Monday for di same reason.

British Airways don cancel flights to Tel Aviv and Bahrain until Wednesday and dem don also warn of impacts on services to Abu Dhabi, Amman, Doha and Dubai.

Virgin Atlantic don also cancel flights between London and Dubai and London and Riyadh on Sunday and Monday.

Singapore Airlines and Air India dey part of di oda airlines wey don change dia schedules for di wake of events for di Middle East.

Revenge strikes from Iran bin continue on Sunday as explosions blast for Doha, Dubai and Manama.

Iran use ballistic missiles and drones to launch wide-scale attacks on US allies and assets across di Gulf, afta dia supreme leader die for inside di ongoing US-Israel air offensive wey dem launch on Saturday morning.

Qatar, Bahrain, Jordan and Kuwait - all home to US military bases – say dem intercept missiles wey Iran fire towards dem, but falling debris appear to don cause widespread damage.

Also for Dubai, debris from one "aerial interception bin cause fire for one berth for di Jebel Ali deep sea port - di world ninth busiest port.

Pipo run across one road wit black smoke for di background.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Authorities say dem intercept multiple missiles and drones ova Dubai since Saturday, including for Jebel Ali port

One large explosion strike di Palm Jumeirah, Dubai luxury man-made archipelago, di five-star Fairmont, di Palm hotel.

Video wey BBC verify show as fire burn di five star hotel and black smoke rise into di sky.

Authorities also confam say debris from one intercepted drone cause one "minor fire" on di outer facade of di five-star Burj Al Arab hotel.

For Bahrain, di interior ministry tok say di airport dey damaged afta one drone touch am.

On Saturday, Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) say dem strike di headquarters of di US Navy Fifth Fleet, wey dey located for Bahrain capital Manama.

Pipo see as big black smoke dey rise from one area near di base.

Meanwhile, Oman state news agency report say two drones bin target Duqm commercial port, and e injure one worker.

List of airlines wey don cancel flights to di Middle East

Pipo stand for airport counter wit dia luggage

Wia dis foto come from, Reuters

Airlines don continue to cancel and divert flights wey dey serve di Middle East afta di US and Israel launch strikes against Iran.

British Airways and Virgin Atlantic dey among carriers to pause flights, as dem suspend flights in and out of Dubai International and Al Maktoum International airport for Dubai.

  • Qatar Airways don confam di temporary suspension of flights in and out of di capital, Doha, sake of di closure of Qatari airspace, dem say operations go resume at 19:00 local time on Sunday (16:00 GMT)
  • British Airways don cancel services to Tel Aviv and Bahrain until Wednesday. Dem say services between Heathrow and Abu Dhabi, Amman, Bahrain, Doha, Dubai or Tel Aviv fit dey affected for several days
  • Aegean Airlines, Greece largest carrier, don suspend flights to and from Tel Aviv, Beirut and Erbil until Monday
  • Air Astana don cancel all flights to di Middle East until di end of Tuesday
  • Air Canada don cancel flights to Dubai until Tuesday, and to Israel until next Sunday
  • Spanish carrier Air Europa cancel services to Tel Aviv until at least Monday
  • Air India don cancel flights from Delhi, Mumbai and Amritsar to a number of destinations including London, New York and Paris
  • Azerbaijan Airlines don suspend flights in and out of Dubai, Doha, Jeddah and Tel Aviv
  • FlyDubai don suspend flights to and from Dubai until 15:00 local time (11:00 GMT) on Sunday
  • Indian airline Indigo cancel dozens of flights until Tuesday sake of airspace restrictions
  • ITA Airways don suspend flights to and from Tel Aviv and say dem go avoid Israeli, Lebanese, Jordanian, Iraqi and Iranian airspace until next Saturday
  • KLM don cancel services to Dubai, Dammam and Riyadh, dem already don suspend dia Amsterdam-Tel Aviv service
  • LOT suspend flights to Tel Aviv until 15 March, and cancel flights to Dubai and Riyadh until Monday
  • Lufthansa don suspend services to and from Tel Aviv, Beirut and Oman until next Saturday, and flights in and out of Dubai on Sunday
  • Norwegian Air suspend all flights to Dubai until Wednesday
  • Pegasus Airlines cancel all services to Iran, Iraq, Jordan and Lebanon on Sunday
  • Turkish Airlines don cancel flights to Lebanon, Syria, Iraq, Iran and Jordan on Sunday
  • Wizz Air don suspend all flights to and from Israel, Dubai, Abu Dhabi and Amman up until and including next Saturday
  • Virgin Atlantic say dem dey suspend services between Heathrow and Riyadh on Sunday, afta dem earlier cancel flights from Heathrow to Dubai on Saturday and Sunday. Di airline warn say flights to India, Saudi Arabia plus di Maldives fit take longer sake of sayy de reroute dem around the affected region