'King Mitchy no be our patient' - Prime Care Hospital react to report of social media influencer death

King Mitchy
Read am in 1 mins

Di management of Prime Care Hospital for Abuja say na fake news, di tori wey dey spread say popular Nigerian content creator and influencer Mukoro Mitchel wey pipo sabi well as King Mitchy allegedly die for dia hospital.

Prime Care Hospital for statement wey dem share wit BBC News Pidgin clear am say King Mitchy no be dia patient and e no die for dia facility.

Dia clarification dey come afta King Mitchy management allegedly release one statement on her Instagram page wey claim say di young philanthropist don pass on.

Nigerian philanthropist King Mitchy sidon for chair. She wear one blue and nude colour top and one nude coloured trouser.
Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

"We dey deeply heartbroken to share say our beloved Michele don pass on. Despite all di efforts of di medical team here for Abuja, dem tell us say her condition dey critical and sadly dem no fit revive her," Di statement wey allegedly quote King Mitcy management tok.

Di statement add say "if you no Prime hospital for Abuja, beg dem to do sometin to save her."

Insta story post

Wia dis foto come from, King Mitchy/Instagram story

Dis dey come days after di influencer dey in di news sake of her humanitarian work.

We still dey update dis tori!