Grey's Anatomy star Eric Dane die at di age of 53 after dem diagnose am wit ALS

Eric Dane wear glass and dey look camera

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Grey's Anatomy star Eric Dane
    • Author, Jessica Murphy
  • Read am in 4 mins

Eric Dane, di actor wey pipo sabi well well for im roles for Grey's Anatomy and Euphoria, don die less dan one year after e reveal say e get amyotrophic lateral sclerosis (ALS). E be 53.

Dane act as di family patriarch Cal Jacobs for di hit HBO teen drama show Euphoria. Before dat, pipo bin sabi am well well as Dr Mark Sloan, or 'Dr McSteamy', inside di medical drama Grey's Anatomy.

Dem diagnose di California-born actor last year wit ALS and e spend di last few months raising awareness for di most common form of motor neurone disease (MND).

"Wit heavy hearts, we share say Eric Dane pass on Thursday afternoon after a courageous battle with ALS," di statement from im family tok.

E bin dey married to fellow actress and model Rebecca Gayheart, wey e get two children wit.

Di statement say e spend im final days surrounded by friends and im devoted wife, and im two daughters, Billie and Georgia, "wey be di center of im world".

"E go dey deeply missed, and lovingly remembered always. Eric adore im fans and dey forever grateful for di outpouring of love and support e bin receive," e tok.

Dane also act Jason Dean inside di fantasy drama series Charmed, and Captain Tom Chandler for di action drama show The Last Ship, while e also appear for films like as Marley & Me, Valentine's Day and Burlesque.

Eric Dane and Rebecca Gayheart for one ball for Brentwood, California, on 3 June 2017

Wia dis foto come from, FilmMagic

Wetin we call dis foto, Eric Dane and wife Rebecca Gayheart for 2017

ALS, wey dey also known as Lou Gehrig's disease, na a rare degenerative disease wey dey cause a progressive paralysis of di muscles.

E dey affect di nerve cells for di brain and spine wey dey control muscle movement, e dey make patients to slowly lose dia ability to speak, eat, walk and breathe independently.

Last summer, Dane bin tell ABC network Good Morning America say im diagnosis make am "angry".

"Because, you know, my papa die wen I dey young," e tell di programme.

"And now, you know, very good chance dey say my girls too go lose me while dem dey very young".

Im father die by suicide hen Dane be seven years old.

Dem born di actor San Francisco for 1972 and e make im television debut inside Wonder Years 1for993.

Dane's Grey's Anatomy co-stars dey lead tributes to di late actor.

Kim Raver, wey play im on-screen wife, say: "During filming e go get dis twinkle for im eye and wit a mischievous look, e go deliver wit perfect comedic timing, one line of dialogue wey go wow you."

Kevin McKidd, wey play trauma surgeon Owen Hunt for di series, post "rest in peace buddy" on Instagram.

Euphoria creator Sam Levinson tell Variety say "I dey heartbroken by di loss of our dear friend."

"Working with am na honor. Being im friend na gift," e tok.