Gospel legend Ron Kenoly die at 81

Wia dis foto come from, Ron Kenoly/Facebook
Legendary American gospel singer and song writer Ron Kenoly don die.
Di popular worship leader die on Tuesday, 3 February at di age of 81.
Im music director Bruno Miranda confam im death on top di singer official Instagram account.
"Dis morning, Feb. 3, 2026, we tok goodbye to Dr. Ron Kenoly," Miranda tok.
For im last post on Instagram on Sunday, 1 February, Oga Kenoly bin list di names of some pipo wey help am for im ministry of ova 40 years and tank dem specially for di post.
"I be 81 and in my 48th year of ministry. Dis na some of dose wey help me get to ova 123 nations around di world for ova di past 20 years…"
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Plenty tributes don already dey pour in for di legendary musician from all ova di world.
Im music director for im tribute say, "For ova 20 years, I bin get di honour of walking alongside am for ministry around di world, no be just as im music director, but as a son, a student, and a witness to a life marked by faithfulness."
Miranda add say Oga Kenoly dey veri intentional about one tin: e no be artist, neva an entertainer. E be worship leader. And e go take all di time necessary to explain wetin e truly mean. "A worship leader calling no be to perform songs, but to lead pipo into true worship for di presence of a King; di King of Kings, Jesus Christ."
Today we grieve deeply but not witout hope. Di worship e live na now di worship e behold, Miranda add.
Nigeria Bishop Wale Oke also mourn di death of di worship leader as e describe am as "a man of humility, a vessel of grace, and a true worshipper wey give im life to di glory of God."
E add say "Though our hearts dey heavy, we submit to di perfect will of God, taking comfort in di blessed assurance say life spent in faithful devotion no eva dey in vain. Im Spirit-filled songs, im legacy, and im impact go continue to speak across generations."
Oda gospel ministers like Don Moen wey dem be share stage togeda around di world many times, Panam Percy Paul, Nathaniel Bassey, Dunsin Oyekan and many odas don also pay tribute to di legend.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Who be Ron Kenoly?
Ron Kenoly na worship leader wey dey known for im popular worship songs like Jesus Is Alive, Sing Out, My God Is Able" among odas.
Im Integrity Hosanna Music album Lift Him Up, wey e bin release for 1992, dey certified Gold, as e sell more dan 500,000 copies at di time.
E start to dey sing for one Baptist church for im hometown, Coffeyville for Kansas. Afta e graduate from High School, e join di military. Wen e comot di military, e start to dey sing different kain songs, including secular songs, but na for 1985, e enta full worship ministry.
Till di time of im death, di worship leader bin still dey sing, e dey on di faculty of two different universities for di US, e dey travel all around di world to minister, e get one mentoring program for pastors, musicians, worship leaders, choir directors, anybody wey dey involved for di music ministry of di church, congregation or parachurch organisation.










