Who be Pastor Nkechi Ene of The Carpenter's Church wey die?

Pastor Nkechi Ene

Wia dis foto come from, The Carpenter's Church

Read am in 3 mins

Tears flow as The Carpenter's Church announce di death of dia presiding pastor and spiritual leader, Pastor Nkechinyere Ene.

Pastor Nkechi as dem dey call her die on Wednesday, October 29, 2025 at di age of 56, di Church confam.

For statement wey Pastor Sola Akinwale sign, di church reveal say Pastor Nkechi Ene recently return from a ministry trip but she reportedly experience a sudden health crisis while she dey Lagos and afta small time, she die.

"As our hearts dey hurt and kwesions dey our minds, we rest assured in di truth say God dey good and Im mercy endure forever. Pastor dey for better place, for to dey wit Christ dey far better," di statement tok.

Pesin wey dem describe as a woman of great faith and dedication, Pastor NKechi Ene live life of service, teaching di Word of God and impact lives.

She be one of di first female ministers wey start breakfast bible study programme, Freshdew on television for Port Harcourt, Southern Nigerian in di 1990s.

She later rise to be di lead pastor of The Carpenter's Church afta di founding pastor, late Pastor Charles Omofomah die for 2013.

Pastor Nkechi Ene

Wia dis foto come from, The Carpenter’s Church

Wetin we call dis foto, Many tears and tributes flow as news of her passing spread

Who be Pastor Kech?

Pastor Nkechi Ene (nee Chijioke) na full time minister of di gospel wey serve as Associate Pastor to Pastor Charles Omofomah until im death on 27 February 2013.

She come serve as Presiding Pastor of The Carpenter's Church and Director of Schools at Ekklesia School of Local Church. She also continue as di host of Freshdew, wey begin for April 1988.

Na for Accra Ghana dem born Pastor Nkechi on 24 February, 1969 and she spend most of her early years in Lagos, Western Nigeria.

She be graduate of di University of Nigeria, Nsukka wit First Class Honours Degree in Electronics Engineering.

Pastor Kech (as dem dey fondly call her) na woman of God wey dey pursue excellence in di tins of God wit transparency and tireless dedication.

She be regular minister for many Christian conferences both for Nigeria and internationally and she don write many books, like "No Fear Here" and 'Dancing With Your Spirit."

She dey married to Emeka Ene, an Engineering Executive and dem born two daughters, Zoe and Chloe along wit dia adopted daughters, Tracy and Osi.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Tears and tribute follow di announcement of her passing as many describe her as a mother in Israel.

From pipo wey sabi her from her television ministry to those wey also be ministers demsefs, describe her as a woman of God wey break barriers at a time wen many women bon no dey in full-time gospel ministry.