Charlie Kirk die afta dem shoot am for campus event for Utah, President Trump tok

Wia dis foto come from, OLIVIER TOURON/AFP VIA GETTY IMAGES
Conservative activist Charlie Kirk don die afta dem shoot am for one campus event for Utah, US President Donald Trump tok.
Kirk - wey be influential ally of di president - dey known for holding open-air debates on campuses across di kontri.
"Di Great, and even Legendary, Charlie Kirk, don die," Trump write. "No one understand or get di Heart of di Youth for di United States of America beta dan Charlie."
Dem take one suspect into custody but later release am - di university say di shot bin dey fired from around 200 yards away.
One video show Kirk as dem dey ask am about mass shootings bifor di shot bin dey fired.
Shock dey for di White House wen di news break, Bernd Debusmann Jr report.
Kirk bin dey close to both di president and im family - for January e bin fly to Greenland wit Donald Trump Jr.
Kirk bin tok about gun violence moments bifor dem shoot am, video show
Warning: Dis post contain graphic descriptions of di shooting wey fit turn your belle.
Inside videos of di event wey dey circulate for social media, Charlie Kirk wear white gazebo and dey address crowd wey gada for one event for Utah Valley University.
Di tent get di words, "The American Comeback Tour" - di name of im current speaking tour.
For one video, one audience member ask Kirk about mass shootings for America: "You know how many mass shooters wey don dey for America ova di last 10 years?"
Holding one microphone, Kirk respond: "Counting or not counting gang violence?"
One loud gunshot sound and Kirk appear to jolt backward for im seat. Blood dey for im neck.
Pipo for di crowd scream and start to dey run from di area.
Pelosi and Giffords react to Kirk shooting
US politicians dey share dia shock afta di shooting of Charlie Kirk.
Congresswoman Nancy Pelosi, wey be Democrat, bin tok say she dey pray for Kirk recovery.
"Political violence absolutely no get place for our nation. Make all Americans pray for Charlie Kirk recovery and hold di entire UVU community for our hearts as dem dey endure di trauma of dis gun violence," she write on X.
Former US representative Gabby Giffords also post and condemn violent responses to political differences. For 2011, dem shoot Giffords for head during one meeting wit constituents for one grocery store parking lot. She survive am, but resign from office sake of brain injury.
"Democratic societies go always get political disagreements, but we must neva allow America to become kontri wey dey confront dose disagreements wit violence," she tok.
Who be Charlie Kirk, di conservative youth organiser and Trump ally?
Charlie Kirk na one of di most high-profile conservative activists and media personalities for di US and trusted ally of President Donald Trump.
Kirk wey be 31 years old dey known for holding open-air debates on campuses across di kontri.
For 2012, at di age of 18, e bin co-found Turning Point USA (TPUSA), wey be student organisation wey aim to spread conservative ideals for liberal-leaning US colleges.
Im social media and daily podcast dey usually share clips of how e dey debate wit students about issues such as transgender identity, climate change, faith and family values.
Kirk wey be di son of architect grow up for well-to-do Chicago suburb of Prospect Heights.
E bin attend community college near Chicago bifor e drop out to devote imsef to political activism. E bin apply unsuccessfully for West Point, di elite US military academy.
Kirk bin marry one former Miss Arizona, and dem get two children togeda. Dem see Kirk as both di future of conservative activism and highly polarising figure.










