Who be Joseph Ladapo, di surgeon general wey wan end compulsory vaccine orders

Florida Surgeon General Joseph Ladapo dey tok for one press conference for April 2024.

Wia dis foto come from, Orlando Sentinel via Getty Images

Wetin we call dis foto, Florida Surgeon General Joseph Ladapo dey tok for one press conference for April 2024.
    • Author, Kayla Epstein
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Di surgeon general of Florida don vow to end compulsory vaccine for di state, even vaccine for children.

Dr Joseph Ladapo announce on Wednesday, 3 September plans to wipe "all of dem, every last one of dem" off di books.

E compare di requirements of vaccine to slavery. E get some vaccines like polio wey children must get bifor dem go fit get admission to public schools.

"Who I be to tell you wetin suppose dey your pikin body?" e ask. "I no get dat right. Your body na gift from God."

Dr Ladapo bin gain national attention afta e dey appointed as Florida doctor during di Covid-19 pandemic for issuing notices wey contradict guidance from federal health authorities.

Earlier dis year, e also be one of di top names di Trump administration bin dey consider to run di Centers for Disease Control (CDC).

As President Donald Trump and Health Secretary Robert F Kennedy Jr dey push to change di kontri vaccine and immunisation policies, Ladapo go gain more national attention, and scrutiny.

Immigrant wey get two degrees from Harvard

Ladapo, wey migrate wit im family go di US from Nigeria wen e be five, get im medical training plus PhD in health policy from Harvard University.

Apart from say e dey head Florida health department, e dey teach medicine for di University of Florida and e dey carry out research on minimising cardiovascular risk among disadvantaged and low-income groups, according to im official state biography.

Di Tallahassee Democrat bin report say im total salary, wey include university teaching, pass $350,000 (£261,000) a year.

Wen dem put Ladapo name forward for di high-profile role, Wilton Simpson, di den Florida Senate President, tell Politico say: "E be like say e dey very highly qualified, and certainly e get di credentials to make a great surgeon general."

Earlier dis year, di doctor wey Trump nominate to head di CDC withdraw im name from consideration. E den endorse Ladapo, wey im name come out on a short list of possible directors, according to CBS News, BBC US partner.

Di position for give am big influence on di major changes in vaccinations and disease prevention measures wey Kennedy, wey share im doubts on vaccine dey make.

Dr Susan Monarez, later get di job but Oga Trump recently fire her to.

Di Florida Department of Health no immediately respond to one request for comment on a potential Ladapo nomination for di position.

Ladapo challenge vaccine mandates

Only six US states get surgeons general, wey typically dey charged wit advocating for beta health and disease prevention, plus to educate di public. Ladapo also dey head di state large and complicated health department.

E assume di role of surgeon general for September 2021, one critical time during Covid-19 pandemic. Few months earlier, US bin start to administer vaccines to millions of Americans.

Though public health officials and leading medical associations support di safety of Covid vaccines, and dem develop di vaccines at di instruction of di first Trump administration, some pipo for di kontri bin dey careful of di jabs. Many Republican political leaders, wey include Florida Governor Ron DeSantis, wey appoint Ladapo, oppose directives for di shots.

Wen e enta office, Ladapo challenge di requirement of mask to curb di spread of di virus and e relax di rules to make am easier for children to return to school.

Throughout im tenure, e don issue statements on Covid-19 vaccines wey seem to contradict guidance from agencies like di Food and Drug Administration, Centers for Disease Control, and vaccine experts.

For 2022, Ladapo bin issue one notice warning of one "abnormally high risk of cardiac-related death" for young men wey take di vaccine. Multiple public health experts condemn im analysis and di research wey e use as basis for dis assessment.

"I dey careful to even call am a paper; as e no dey published anywhere," Robert Wachter, chairman of di department of medicine for di University of California for San Francisco" tell Washington Post at di time. "Di idea say e dey use [di analysis] … to change policy — no get any scientific backings to am."

For 2023, POLITICO report say Ladapo don change one state-driven study about di vaccines.

Using public records, di outlet discover say Ladapo changes bin suggest a higher risk of cardiac death pass wetin di study previously suggest. Di changes bin suggest a higher health risk for young men pass wetin medical experts bin previously establish.

Ending vaccine mandates for Florida

Bifor Florida announce dia move to end all vaccine requirements, DeSantis bin ask CDC to stop to dey recommend di Covid-19 vaccine for children for March.

E also say make authorities stop compulsory vaccines wey dey use mRNA technology. Two major Covid-19 shots wey Pfizer-BioNTech and Moderna manufacture na mRNA vaccines.

For one statement, Ladapo tok say canceling di requirements "go strengthen di sovereignty of patients." E also say govment no get di right to tell pipo wetin to put for dia bodies and say di orders na di same as slavery.

Di health department wey Ladapo dey lead go fit revoke some of di mandates straight away, but na state legislature go fit reverse odas .

Already, though, national experts, professional groups and public health officials don react to di move.

"Wen everybody for school dey vaccinated, e go dey hard for diseases to spread, and easier for everyone to keep di fun and learning going," president of di American Academy of Paediatrics, Susan Kressly, tok for one statement on Wednesday, she warn say di plans fit "put children for Florida public schools at higher risk for getting sick."

"Wen children dey sick and miss school, parents also miss work, wey no go only affect those families, but also di local economy," she tok.