DR Congo confam fresh outbreak of Ebola virus - Wetin we know

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Farouk Chothia
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
At least 15 pipo don die for one new outbreak of Ebola virus for di Democratic Republic of Congo, di kontri health ministry tok.
Dem confam di first case of di virus for one 34-year-old pregnant woman, wey dem admit to hospital for August, afta she show symptoms wey include high fever, multiple haemorrhages and repeated vomiting.
She later die sake of multiorgan failure afta few days, di ministry add.
Four health workers dey among di 15 pipo wey die, di ministry tok.
Dis go be di 16th outbreak of di deadly virus for di central African state wey get poor health services, and wey dey face conflict for di east.
Authority say di latest outbreak na for central Kasai province, wit 28 suspected cases recorded.
Officials don advise strict compliance to preventive measures, wey include frequent handwashing and social distancing for high-risk areas.
Tests don identify di Zaire strain of Ebola, one rare but often deadly disease, officials tok.
Di World Health Organisation say investigations dey go on for di affected areas, wia patients don show symptoms wey include fever, vomiting and diarrhoea. Di health body warn say case numbers go likely rise as transmission continues.
Di World Health Organisation tok say dem don deploy national rapid response team plus di WHO have been deployed go di area to strengthen disease surveillance, treatment and infection prevention and control in health facilities.
Dem also dey deliver supplies, including protective gear and mobile lab equipment, to strengthen surveillance, treatment and infection control for health facilities.
How WHO dey manage dis new outbreak
WHO regional director, Dr Mohamed Janabi tok say, "'We dey act wit determination to quickly stop di spread of di virus and protect communities. We dey bank on di kontri long-standing expertise to control di viral disease outbreaks, we dey work closely wit health authorities to quickly scale up key response measures to end di outbreak as soon as possible.'
"Case numbers dey likely to increase as di transmission dey go on. Response teams and local teams go work to find di pipo wey fit dey infected and need to receive care, to ensure everyone dey protected as quickly as possible," WHO add for one statement.
DRC get "stockpile of treatments" wey include 2000 doses of Ervebo Ebola vaccine- wey dey "effective in protection against dis Ebola strain," di global health body tok.
E dey expected say dem go move melecines from Kasai go Kinshasa to vaccinate frontline health workers and contacts of confirmed cases.
Di last Ebola outbreak for DR Congo hapun three years ago, and e lead to di death of six pipo.
One outbreak for 2018-20 bin dey far deadlier, e claim more dan 2,000 lives.
Dem first detect di virus, wey pipo reason say originate from fruit bats for 1976 near di Ebola River wey now be DR Congo.
People dey infected wen dem get direct contact through broken skin, or di mouth and nose, wit di blood, vomit, faeces or bodily fluids of someone wit Ebola.
Why Ebola dey always come back
Ebola dey quick spread. Small sweat or spit from pesin or animal wey get di disease fit infect pesin.
According to WHO, new Ebola outbreak go ever dey hapun for Dr Congo because di virus dey live for animal reservoir wey dey for many parts of di kontri.
Fruit bats na di main carrier of di disease, but pipo fit dey infected if dem come in close contact wit blood, organs or bodily fluids of animals wey get di virus like chimpanzees, gorillas, monkeys, antelope and porcupines.
Di disease dey very rampant for dis area and e no go dey possible to destroy all di animals wey fit dey carry Ebola.
As long as pipo dey touch and eat dem, possibility dey say Ebola go always return.










