Which challenges dey face Tunji Disu as acting IGP?

Wia dis foto come from, Nigeria Police/X
- Author, Adesola Abisoye
- Role, BBC News
- Reporting from, Lagos
- Read am in 5 mins
Since di appointment of Assistant Inspector-General of Police Tunji Disu to serve as Acting Inspector-General of Police of Nigeria, eye don dey ground to see how e go fit tackle di different securiti challenges bifor am.
Oga Disu no be small name for di Nigeria Police Force as di positions wey e don hold bifor don position am to interact wit citizens.
Since e join di police force for May 1992, Disu don hold major police positions and one of di ogbonge one na im appointment as di officer wey take ova from Abba Kyari as di new head of police Intelligence Response Team for 2021.
Bifor, di service years of police officers for Nigeria na 35 years but di Nigeria Police Act, 2020 (Amended 2024) come increase am wit five years, and na wetin make Disu take get di grace to serve beyond 2026 be dat.
According to di police act, di pesin wey dey appointed to di office of di Inspector-General of Police fit hold office for just four years.
As replacement for Kayode Egbetokun wey resign President Bola Tinubu go call meeting of di Nigeria Police Council to consider di appointment of AIG Disu as substantive Inspector-General of Police, afta wey dem go carry im name go Senate for confirmation.
Inside all of dis and all of di positions wey Tunji Disu don hold, kwesions dey if e don prepare well for im new role as IGP and how e go tackle di kain challenges wey dey im table like dis.
Challenges wey dey Tunji Disu table
Di office of di Inspector-General of Police no be small one as na im dey head di Nigeria Police Force wit full command and operational control.
According to di Police act, di position of di IGP na veri important one for Nigeria sake of di kain responsibilities wey dey im neck.
- Di 2027 general elections
Di Nigeria 2027 general elections go be one of di biggest test for Oga Tunji Disu as Inspector-General of Police. Dis challenge no be small one becos na one wey extend to evri part of Nigeria.
Di new police oga gatz make sure say police officers dem all ova Nigeria dey ready for di 2027 general election as dem must do dia work without wuru-wuru, so dat during election bad pipo no go fit play wayo, cause wahala or stop pipo from voting.
Meanwhile, Osun and Ekiti gubernatorial election go first start di kain trust wey Nigerians go put for Tunji Disu ahead of 2027, becos dose govnorship dey happun for 2026.
- Police Salary and welfare
For 2018, former president Buhari bin announce increase in police salary but e no stop dia. Plenti call don dey say make dem increase police salary so dia officers go fit afford basic tins and live better life witout compromise.
Tunji Disu go gatz make sure say im officers dey well paid as na di responsibility of di Inspector-General of Police to see to di welfare of police officers.
- Give police new face
Plenti pipo don tok about how di police need to dey independent to fit do dia work and handle issues witout partiality.
Oga Tunji Disu gatz come wit strategy wey fit give Nigeria police new face away from how pipo dey disrespect dem.
Police expert Dennis Amachree say di koko for di police oga na to make Nigerians to start to see police as dia friend.
Security experts tok wetin Tunji Disu fit do
Detective Auwal Durimin Iya, wey be senior security consultant and quality assurance assessor for homeland security for Nigeria, tok say acting IGP, Mr Disu, go face two main challenges for im new position.
For interview wey im do with BBC News Pidgin, Durimin Iya say di challenges na loyalty sabotage and how im go take implement di strategy wey im carry come.
Di first challenge, according to am, na problem of loyalty sabotage for workplace. Im say, "Anytime leader get some pipo wey im trust well-well, and pipo dey complain about am, but nobodi around am fit tell am di truth, na wahala be dat"
If new leader come and e no make changes among dis kain pipo wey dey help am, e go kontinu to get problems for anytin wey e wan implement."
"Anybodi wey dem remove from position suddenly no go happy, and e fit no wan di person wey replace am succeed for di work, even if e tok say e support am, bicos di person sef wan prove imself say im don do im best for dat position."
Di second challenge na how e go tackle security problem for di kontri.
Detective Durimin Iya say Tunji Disu go face challenge to implement im own security strategy. "As new IGP, e go try bring im own ideas on how to improve security."
"Dat one mean say e go try change di current system, and e go need put im own trusted pipo for ground to follow im direction, and dat one sef na big challenge," Durimin Iya tok.









