Corrected: Tunji Disu biograpghy - Wetin you suppose know about di police oga wey dey replace Abba Kyari

Tunji Disu

Wia dis foto come from, Other

Nigeria Inspector General of Police Usman Alkali Baba don announce di appointment of Tunji Disu as di officer wey go take ova from Abba Kyari as di new head of police Intelligence Response Team.

Dis na afta Police suspend Oga Kyari afta US Department of Justice mention im name for di fraud case of Raymond Abbas wey pipo sabi as Huspuppi for America.

Tunji Disu Biograpghy

Dem born Disu Olatunji Rilwan, for Lagos Island, Lagos state, on di 13th of April 1966.

Oga Disu join di police force, on di 18th of May 1992. E dey due for retirement in 2026.

Before dem announce oga Disu as Kyari replacement, im be former Commander of di Rapid Response Squad (RRS) Lagos State, e be di Deputy Commissioner of Police, Department of Operations, Force Headquarters, Abuja.

E bin don also previously serve as di State CID, Rivers State as di Deputy Head of di Unit.

E also be former Commander of di Nigeria Police Contingent to di African Union (AU) Peace Keeping Mission in Dafur, Sudan.

 DCP Disu get Bachelor of Arts degree in English from di Lagos State University (LASU) and Masters Degree in Public Administration from di Adekunle Ajasin University, Ondo State.

E don also attend several professional courses both for home and abroad: Small Arms Smuggling Training for Botswana, Internet Fraud Training for di Cambridge University, UK, Strategic Leadership Command Course for di Police Staff College, Jos, Forensic Investigations and Criminal Intelligence Course for di University of Lagos, amongst others.

E be member of di International Association of Chiefs of Police, Nigeria Institute of Public Relations and Chattered Institute of Personnel management, amongst oda professional bodies.

We don update dis tori.