Tinubu appoint Tunji Disu as acting IGP as Kayode Egbetokun resign

Foto of IGP, Kayode Egbetokun

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force/X

Read am in 4 mins

President Tinubu don approve di appointment of Assistant Inspector-General of Police Tunji Disu to serve as Acting Inspector-General of Police with immediate effect.

Dis na after Kayode IGP, Kayode Egbetokun resign.

One statement from di presidency, im appointment dey come as di kontri dey battle security challenges. "di AIG experience, operational depth, and demonstrated leadership capacity go provide steady and focused direction for di Nigeria Police Force during dis critical period."

Tok-Tok pesin for di president Bayo Onanuga say President Tinubu go call a meeting of di Nigeria Police Council to formally consider di appointment of AIG Disu as substantive Inspector-General of Police, after which dem go transmit im name to di Senate for confirmation.

Earlier, Onanuga bin confam give BBC News Pidgin say Mr Egbetokun resign from office becos of family issues.

"Egbetokun resign today, e cite family issues. Official statement go dey issued later," Bayo Onanuga tok.

Egbetokun assume office as 22nd IGP on 19 June 2023.

Im appointment bin face some backlash sake of how di presidency extend im tenure beyond di mandatory retirement age from 60 to 65 wen im tenure bin end for September 2024.

Di National Assembly bin amend di police law to accommodate di IGP tenure elongation.

For July 2024, di National Assembly pass di Police Act (Amendment) Bill to allow pesin wey dem appoint as Inspector-General of Police to remain for office until di end of di term wey dem tok for di letter of appointment.

President Tinubu bin forward di bill to di House of Representatives and Senate to amend di tenure of di IGP. Lawmakers for both chambers bin pass di bill for separate sittings.

Who be Tunji Disu

Foto of Kayode Egbetokun.

Wia dis foto come from, NPF/X

Olatunji Disu bin just recently get promotion to di rank of Assistant Inspector General of Police and e assume duty as di head of di Force Criminal Investigation Department FCID Annexe Lagos.

For 2023, e get promotion and climb to di position of Commissioner of Police Federal Capital Territory Abuja.

Before e come di CP FCT, e bin serve as di head of di Intelligence Response Team IRT wey be special police unit wey dey answer direct to di police IG.

AIG Disu bin become popular for Nigeria wen e serve as di Commander of di Lagos State Rapid Response Squad RRS from 2015 to 2021.

During im tenure, e name him officers "di good guys". E use dat tag to help push police reforms and make police officers to enforce di law responsibly and wit friendly attitude.

E bin serve as Officer-in-Charge of di Special Anti-Robbery Squad SARS for plenti states including Rivers and Ondo.

Dem born Disu Olatunji Rilwan, for Lagos Island, Lagos state, on di 13th of April 1966.

Oga Disu join di police force, on di 18th of May 1992.

Im be work as former Commander of di Rapid Response Squad (RRS) Lagos State, e bin also serve as di Deputy Commissioner of Police, Department of Operations, Force Headquarters, Abuja.

E bin don also previously serve as di State CID, Rivers State as di Deputy Head of di Unit.

E also be former Commander of di Nigeria Police Contingent to di African Union (AU) Peace Keeping Mission in Dafur, Sudan.

Disu get Bachelor of Arts degree in English from di Lagos State University (LASU) and Masters Degree in Public Administration from di Adekunle Ajasin University, Ondo State.

E don also attend several professional courses both for home and abroad: Small Arms Smuggling Training for Botswana, Internet Fraud Training for di Cambridge University, UK, Strategic Leadership Command Course for di Police Staff College, Jos, Forensic Investigations and Criminal Intelligence Course for di University of Lagos, amongst others.

E be member of di International Association of Chiefs of Police, Nigeria Institute of Public Relations and Chattered Institute of Personnel management, amongst oda professional bodies.