'Nigeria na di deadliest place to be Christian' - US Congress report find

Three women siddon for di front of one burnt church

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

"Nigeria na di deadliest place in di world to be a Christian," US Congressmen report find.

Di report wey US lawmaker Riley Moore and di House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit to di White House on Tuesday, 23 February, discover say Christians dey suffer violent attacks for di hands of well-armed Fulani militias and terrorist groups, wey don lead to di death and murder of tens of thousands of Christians, wey include pastors and priests.

Di report add say thousands of Churches and schools dey destroyed, kidnappings also dey go on.

According to di report findings, blasphemy laws dey for Nigeria northern states wey dem take to silence speech, target Christians plus minorities and justify so called "convictions" without due process.

Congressman Moore tok say di "comprehensive report outline concrete actions to end di persecution of Christians for Nigeria and counter growing extremist violence for di region."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Dis report dey come afta claims of genocide against Nigeria Christians begin circulate last year for some right-wing US circles.

President Trump last year bin ask Congressman Moore and Appropriations Committee Chairman Tom Cole to lead investigation on di persecution against Christian communities and security challenges wey dey border Nigeria afta tori of dia persecution begin spread.

"Dis report na di result of months of investigation, wey include a bipartisan congressional fact-finding trip to Nigeria, hearings wit expert witnesses, consultations wit religious leaders, meetings wit Internally Displaced Persons, and engagement wit senior Nigerian govment officials," Lawmaker Moore tok.

Also for October 2025, US President Donald Trump also declare Nigeria as a "Country of Particular Concern"

E say dis na sake of how dem dey kpai 'thousands of Christians' for di Nigeria.

Inside one post on im Truth Social, Trump say Christians for Nigeria dey face threat and e accuse di govment say dem fail to protect Christians from jihadist attacks.

However, Nigeria bin reject di claims of "Christian genocide," di govment say violence start from terrorism and land disputes, no be religion. Dem add say na both Christians and Muslims don suffer attacks.

Some organisations wey dey monitor political violence for Nigeria say most victims of di jihadist groups na Muslims.

But some Christian leaders however say instances dey wia Christians dey specifically targeted.