Key points from US lawmakers investigation on claims of religious genocide for Nigeria

US flag and Nigeria flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di US lawmakers don begin chook mouth on alleged claim say Christian genocide dey happun for Nigeria.

US President Donald Trump bin give directive to di House Appropriations Committee for October say make dem investigate alleged Christian genocide for Nigeria.

Dis dey come afta US President Trump bin threaten to invade Nigeria afta e bin refer to Nigeria as 'disgraced kontri' and say di USA go move to 'wipe out' terrorists.

Bifor di lawmakers meeting, some high level delegation from Nigeria bin visit di US to see how dem go fit end di insecurity mata wey dey shake Nigeria.

"For all engagements for Washington, DC, di Nigerian delegation reject allegations of genocide for Nigeria, say violent attacks affect families and communities across religious and ethnic lines".

Also, Nigeria President Bola Tinubu don approve constitution of di Nigerian side wey go dey di US-Nigeria joint working group.

Di group na to collabo to tackle di security challenges wey Nigeria dey face. Although di US neva release dia own list of who dey di joint-working group.

'Dis na targeted campaign'

Brian Mast, wey be US House Foreign Affairs Committee Chairman, say di attack wey dey go on for Nigeria na targeted campaign. Mast say no be just communal violence dey happun.

"Dis no be merely 'inter-communal violence' or a 'resource conflict,' as many claim. Dis na targeted campaign of religious cleansing."

Mast say 'weda na Boko Haram, Islamic State West Africa Province, or radicalised nomadic Fulani militants', dia objective na to drive Christians out of dia lands.

Di lawmaker say e dey stand wit President Trump for im decision to redesignate Nigeria as Country of Particular Concern.

"We must demand say di Nigerian govment disarm dis militias, return displaced families to dia homes, and bring di perpetrators to justice."

'Di world no go turn blind eye'

US lawmaker Riley Moore, wey dey lead religious liberty advocate, say Christians dey face crisis just becos say dem dey practice dia faith.

"Our brothers and sisters in Christ dey persecuted and slaughtered in Nigeria simply for professing dia faith in our Lord and Saviour Jesus Christ."

Moore also add say na sake of di crisis make President Trump ask am to look into di 'horrific persecution of Christians for Nigeria.'

"Di world no go turn a blind eye to di persecution of Christians for Nigeria."

'All killings gatz stop'

Honourable Vicky Hartzler, wey be di US Commission on International Religious Freedom Chairman, say all di killings wey dey sup for Nigeria gatz stop.

Hartzler claim say religious freedom dey under serious wahala and e dey get worse.

"Just a few days ago, on November 22nd, dem abduct 303 children and 12 teachers for St Mary's School, a Catholic institution for Niger State.

"No matter di group wey dey do dis violence, we must dey clear: religious freedom violations dey rampant," e tok.

Di US lawmaker also mention di Kwara State case wia jaguda pipo bin attack worshippers. E mention say no be say Muslims too no dey part of dose wey dey kpai but na Christians plenti pass.

"E dey horrible, violent, and Christians na di predominant victims. But no matter di religion of di victim, all killings gatz stop, and di govment gatz take decisive action now to prevent any further killings."

Recommendations wey di US lawmakers make

Di US lawmakers bin issue some recommendations wey go help dem deliver dia work.

Honourable Hartzler highlight some recommendations:

  • Di US govment gatz work directly wit di govment of Nigeria to improve dia accountability and transparency and help for areas of police training and reform, and conflict mediation.
  • Di US govment gatz insist say Nigerian govment officials gatz respond wen dem get early warning, to make sure say resources dey invested in using early warning systems to reduce community violence.
  • Di US govment gatz continue to work wit di Nigerian govment to provide technical expertise and oda forms of assistance to train, support, and counter violent insurgent groups so di entire region fit prosper.

Participants for di investigation

Rep Mario Díaz-Balart (R-FL), House Appropriations Committee Vice Chair and National Security, Department of State, and Related Programs Subcommittee Chairman

Rep Robert Aderholt (R-AL), Labor, Health and Human Services, Education, and Related Agencies Subcommittee Chairman and Values Action Team (VAT) Chair

Rep Riley Moore (R-WV), House Appropriations Legislative Branch Subcommittee Vice Chair and leading religious liberty advocate

Rep Brian Mast (R-FL), House Foreign Affairs Committee Chairman

Rep Chris Smith (R-NJ), House Foreign Affairs Africa Subcommittee Chairman

Honourable Vicky Hartzler, US Commission on International Religious Freedom Chair

Sean Nelson, Alliance Defending Freedom International

Dr Ebenezer Obadare, Council on Foreign Relations