Who and who Tinubu send to go discuss wit US, wetin be di outcome of dia meeting?

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria and di United States of America don meet to chook eye into how di two kontris go collabo for area of security so dem go fit protect Nigerians.
Some high-level Nigerian delegation bin go di US to go meet wit US officials to see how dem go fit end di insecuriti mata wey dey shake Nigeria.
Dis dey come afta US President Donald Trump bin threaten to invade Nigeria afta e bin refer to Nigeria a 'disgraced kontri' and di USA go move to 'wipe out' terrorists.
Trump also threaten to stop all aid and assistance to Nigeria.
For im tok, Trump say, "I dey hereby instruct our Department of War to prepare for possible action. If we attack, e go dey fast, vicious, and sweet, just like di terrorist thugs attack our CHERISHED Christians!" Trump tok, and warn say di govment beta move fast.
Meanwhile, for several times, di Nigerian govment under President Bola Tinubu don reject di claim say Islamist insurgents for di Muslim majority north of di kontri dey target Christians.
Part of wetin di Nigeria senior official delegation go do for di US na to seek support wey also include defence equipment wey go help dem defeat di terrorists.
In di last one week for Nigeria, serious terrorist attacks don rock di kontri and e call for concern among citizens wey dey ask make di govment do sometin.
Bandits on attack Government Girls Comprehensive Secondary School, Maga, wey dey for Danko/Wasagu Local Govment Area of Kebbi State and kidnap school girls.
Bandits attack Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, for Ekiti Local Government Are, Kwara State during di church evening programme, nd kidnap worshippers.
Gunmen bin storm St Mary's School for Niger state, capture 315 students and teachers.
Di one wey come also break heart of Nigerians na wen President Tinubu confam di death of high ranking Nigerian Army officer, Brigadier General Musa Uba wey die in di line of duty during ambush by terrorist group.
All dis happun for inside one week, and e dey part of why di Nigerian delegation bin go US to find support against di terrorist operations.
Who dey di delegation?
Some high level delegation pay visit to di US congressman, Riley Moore, wey be one of di pesin wey President Trump bin appoint to dey monitor di issues for Nigeria.
During di meeting, dem tok on di different terrorist threats for Nigeria and ways to end di killings wey dey hapun for di kontri.
Also, di meeting bin allow di Nigerian govment to fit cooperate wela and build beta relationship between Nigeria and di United States.
"During di meeting, Nigerian officials share dia govment challenges and concerns regarding counter-terrorism, security assistance, protection of vulnerable communities, and ongoing issues wey involve violence across Nigeria," Riley tok.
According to di statement by Bayo Onanuga wey be di president tok tok pesin, e say na di National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, bin lead di delegation wia dem meet wit senior officials 'across di US Congress, di White House Faith Office, di State Department, di National Security Council, and di Department of War.'
Di Nigerian delegation wey go US include:
- Mallam Nuhu Ribadu – National Securiti Adviser and leader of di Delegation
- Her Excellency, Bianca Ojukwu - Minister of State for Foreign Affairs
- Kayode Egbetokun - Inspector General of Police
- Lateef Olasunkami Fagbemi, SAN - Attorney General of di Federation
- General Olufemi Oluyede - Chief of Defence Staff
- Lt. Gen. Emmanuel Undiandeye - Chief of Defence Intelligence
- Ms. Idayat Hassan - Special Adviser to ONSA
- Ambassador Ibrahim Babani - Director of Foreign Relations, ONSA
Wetin Nigeria delegation discuss for US
US President Trump bin don threaten possible military action for Nigeria as e accuse di Nigerian govment say dem allow di killing of Christians.
Trump don even declare Nigeria 'Country of Particular Concern' but Minister of Foreign Affairs for Nigeria, Ambassador Yusuf Tuggar tok say oga Trump position no really gel wit wetin dey happun for ground for Nigeria.
Dis visit to di US don also help Nigeria reject claims of genocide for Nigeria.
"For all engagements for Washington, DC, di Nigerian delegation reject allegations of genocide for Nigeria, say violent attacks affect families and communities across religious and ethnic lines."
"Di delegation strongly reject wrongful framing of di situation, saying such would only divide Nigerians and scatta di realities on di ground."
According to Onanuga, e say di US govment don ready to cooperate wit Nigeria. E say dem go get support for areas of equipments, intelligence and odas.
"Sake of dis engagements, di United States goment don tanda gidigba to deepen security cooperation wit Nigeria."
"Dis include enhanced intelligence support, expedited processing of defence equipment requests, and di potential provision of excess defence articles subject to availability to fit ginger well for di ongoing operations against terrorists and violent extremist groups."
For di meeting between di two kontris, e say di US don express da mind to give support wey go include "humanitarian assistance to affected populations for di Middle Belt and technical support wey go help early-warning mechanisms."
"Di two kontris agree to implement immediately a non-binding cooperation framework and to establish a Joint Working Group to ensure unified and coordinated approach to di areas wey dem don agree to cooperate".
agreed areas of cooperation.
Di Nigeria delegation come say di govment go use civilians measures to take protect di citizens.








