Two girls escape as search begin for oda schoolgirls wey bandits kidnap for GGCSS Kebbi

Two out of di 25 schoolgirls bandits kidnap for Government Girls Comprehensive Secondary School, Maga, Kebbi state don escape from dia captors.
Sources wey dey close to di school confam am to di BBC.
Di source wey no want make im name come out say e no clear how dem escape, but dem see di two gilrs early mor-mor on Tuesday.
Dis dey happun as di Nigerian govment don begin serious efforts to rescue di oda 23 wey remain.
Bandits on Monday attack Government Girls Comprehensive Secondary School, Maga, wey dey for Danko/Wasagu Local Govment Area of Kebbi State and kidnap di girls.
Kebbi State dey for Northeast Nigeria and dis no be dis frist time dis kain mata dey happun.
Chief of Army Staff Lt Gen Waidi Shaibu land for Kebbi to ginger troops of Operation Fasan Yanma make dem no leave any tin to chance for di rescue of di girls.
Di Chief of Army Staff come wit senior officers from Army Headquarters hold also operational meeting wit frontline commanders, and later address di troops wey dey involved for di search.
How bandits kidnap di 25 schoolgirls
Pipo for Maga wake up wit fear and sadness afta one bad attack wey bandits carry out early Monday morning, wia dem kill two pipo and kidnap secondary female students according to locals.
Tori be say bandits capture 25 students from di school for early hours of Monday.
Di attack happun for the school wey dey Danko/Wasagu Local Government Area of Kebbi State, northern Nigeria.
Local sources tell BBC News Pidgin say di bandits kill one school teacher bifor dem carry di girls, and later kill one school security guard.
Pipo for di town tok say before di bandits enta di area, dem hear say di bandits don attack and kidnap pipo for some villages wey near Maga on Sunday.
One pesin wey dey di town, Malam Abdullahi, tell BBC News Pidgin wetin hapun, e say di attack hapun for early morning wen pipo dey prepare for morning prayer.
"Around 3:30am we hear gunshot, but we tink say na local vigilante dem wey dey patrol."
"Later we hear heavy gunshot around 4:30am, and wen I comot, we see pipo dey run comot from di school wia di bandits enta do di attack."
Victim tok how bandits kill her husband
One woman wey her husband die for di attack tok how armed men enta dia house around 3am before dem carry di schoolgirls from di hostel.
Di woman tell tori pipo say di wahala start wen she hear movement outside dia window.
"Around 3am I hear movement for back of our window. I try wake my husband make I tell am say maybe na animals dey scatter our tins outside."
But bifor she and her husband fit understand wetin dey happun, di arm men don break dia door enta.
"We start to struggle wit dem, one of dem pull gun shoot my husband."
"One of di bandits drag my hand go outside. I tell am make e leave me, say I no go follow dem since dem don kill di father of my children."
As she dey argue wit di attackers, her daughter come outside. Na dat time di gunmen leave her and carry di girl.
"Dem carry my daughter go, make she lead dem to di hostel."
Federal and state govment reactions

Wia dis foto come from, Mustapha Ibrahim
Di federal Govment don show deep concern and solidarity wit families of di female students wey bandits abduct from di school.
Dis one dey inside statement wey Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, release on Monday.
Di statement tok say President Bola Ahmed Tinubu don reiterate say protecting evri Nigerian especially schoolgirls na serious responsibility of govment.
Govment condemn di bad attack on innocent students and di killing of school officials wey dey do dia work.
"We feel dia pain, and we dey fully committed to bring the girls back safely."
"Our security and intelligence agencies don get clear instructions to locate, rescue, and return di students safely, and also ensure say dos wey commit di crime go face justice. Federal Govment no go rest until we achieve dis" di statement tok.
According to di statement, Federal Govment dey adjust di kontri military, police, and intelligence system to prevent more attacks and to respond faster and more effectively wen threats show.
While on di oda hand, Kebbi State Governor, Nasir Idris, tok say e don assure parents of di schoolgirls wey bandits carry from GGCSS Maga say efforts dey on ground to rescue dia children.
Di govnor yarn dis one on Monday afta im visit Maga, wia di incident happun, and afta closed-door meeting wit security agencies, traditional rulers, and parents of di kidnapped students.
"Di unfortunate tin don happun. Dem don kidnap our children, we come here, see tins by ourses, and meet di parents wey dia children bin kidnap" Govnor Idris tok.
"We give dem confidence and assure dem say we go do evritin possible to rescue dia children.
"We also encourage dem make dem stay strong, and dat security agencies go do evritin necessary. Na why we come Maga to see di pipo and give dem hope."










