'We no go rest until we rescue di girls ' - FG tok afta bandits kidnap 25 schoolgirls for Kebbi state

Sign post of di school wia bandits kidnap schoolgitls for Kebbi

Wia dis foto come from, Mustapha Ibrahim/BBC

Read am in 5 mins

Nigeria government tok say dem don issue clear directive give di kontri security and intelligence agencies to "locate, rescue and safely return" di female students gunmen kidnap for Government Girls Secondary School, Maga, for Danko/Wasagu Local Government Area of Kebbi State, north-west Nigeria.

Di Minister for Information Mohammed Idris for statement tok say govment no go rest until di girls regain freedom and those wey carry out dis act face justice.

Di minister statement dey come afta Nigeria police force confam say gunmen wey dem suspect to be bandits storm di school, kidnap 25 school girls and kill some school officials.

"Di govment condemn dis inexcusable attack on innocent students plus di killing of school officials wey dey carry out dia noble duty," e tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Pipo for Maga wake up wit fear and sadness afta one bad attack wey bandits carry out early Monday morning, wia dem kill two pipo and kidnap secondary female students according to locals.

Pipo for di town tok say before di bandits enta di area, dem hear say di bandits don attack and kidnap pipo for some villages wey near Maga on Sunday.

One pesin wey dey di town, Malam Abdullahi, tell BBC News Pidgin wetin hapun, e say di attack hapun for early morning wen pipo dey prepare for morning prayer.

"Around 3:30am we hear gunshot, but we tink say na local vigilante dem wey dey patrol."

"Later we hear heavy gunshot around 4:30am, and wen I comot, we see pipo dey run comot from di school wia di bandits enta do di attack."

Foto of slippers of children wey bandits bin kidnap for 2021

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFP via Getty Images)

E add say di bandits first enter di teachers houses befor dem go carry di students wey dem kidnap.

"Di wife of di teacher wey dem kill tell us say di bandits enter dia house meet her husband for wia e lie down. Dem ask am weda na im be di school chief security. Wen e answer yes, dem tell am say today na im last day.

"She tell us say her husband beg dem make dem allow am sidon befor dem kill am. As e sidon, dem shoot am for chest," Abdullahi tok.

E tok say afta dem kill am, dem tell im daughter make she carry dem go di hostel wia di students dey.

"Afta dem kill di teacher, dem carry im pikin make she show dem di hostel wia di students dey. Na so dem pack all di children, and as dem dey comot wit dem, dem shoot di school security man," e tok.

Abdullahi tell BBC say dem bin don call security pipo for help bifor di attack hapun for dia town. E confirm say sojas come yesterday and dem dey for di town reach about 2:00am.

As tins be now, reports from Maga show say security pipo don full ground and all di traditional rulers for di area don reach di school to know wetin happun.

Police deploy force to rescue Kebbi school girls wey bandits kidnap

Front gate of di school wey bandits attack

Wia dis foto come from, Mustapha Ibrahim

Kebbi State Police Command say dem don deploy police tactical units, sojas and vigilante pipo to begin serious search-and-rescue operation for di 25 school girls wey bandits carry from Govment Girls Comprehensive Secondary School, Maga, for Danko/Wasagu Local Govment Area.

Nafiu Abubakar Kotarkoshi, tok-tok pesin for di Kebbi State Police Command say armed bandits enta di school around 4:00am on Monday, dey shoot anyhow.

Police tactical team wey dey inside di school engage dem for gun battle, but di bandits still manage jump fence and carry di girls comot go unknown place.

According to di Police one man, Hassan Makuku, die for di attack, and anoda man, Ali Shehu, injure for hand.

Afta di incident, Police Command say dem don send more police officers join, plus military and vigilante, and all of dem dey comb di bandits dia possible route and nearby forest to rescue di girls and arrest di pipo wey do di bad act.

Kebbi State Commissioner of Police, Bello Sani, reassure say police dey fully committed to protect pipo life and property.

Some school attacks wey don hapun for Nigeria

  • Chibok Girls Secondary School

On April 14, 2014, Boko Haram attack one girls' secondary school for Chibok, Borno State, carry many students.

Dem enta di town around midnight, shoot anyhow to wake residents, enter hostel, pack 276 girls inside truck, and kidnap dem.

  • Dapchi Girls Secondary School

For February 2018, suspected Boko Haram militants attack one girls' school for Dapchi, Yobe State, and carry 110 students.

Dis one hapun almost four years afta dem kidnap the Chibok girls.

  • Kankara Science Secondary School

For December 2020, gunmen attack one boys science secondary school for Kankara, Katsina State.

Dem kidnap more dan 300 students and carry dem travel long distance enter forest for Zamfara, one place wey also dey face insecurity.

  • Jangebe Girls school

For February 2021, gunmen attack GGSS Jangebe, one girls boarding school for Zamfara State.

Dem kidnap around 317 students. One eyewitness tell BBC say about 300 girls remain afta the attackers comot.

  • Kuriga school

For early March 2023, gunmen attack Kuriga Primary and Junior Secondary School for Chikun Local Govment Area of Kaduna State.

Dem kidnap about 287 students and one teacher - di teacher later escape.

Wen Governor Uba Sani visit di community, di teacher tell am say di attackers reach di school just as di morning assembly dey finish.