PDP don scatter? How dismissal of Wike, Fayose fit affect Nigeria main opposition party

Nigeria biggest opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) don turn into one day one wahala sake of internal gbas-gbos wey dey threaten to tear di party apart.
Ova di weekend, one faction of di party organise dia national convention for Ibadan Oyo State, wia dem agree to expel di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike, di national secretary Sam Anyanwu, former Ekiti State guvnor Ayo Fayose, and odas.
Howeva, dis Monday morning, di same Anyanwu wey suppose dey suspended, don call for emergency meeting of di party Board of Trustees and di National Executive Committee. Di meeting go hold on Tuesday.
For di invite wey don circulate for social media, Anyanwu tok say important matters go dey discussed and addressed.
E no clear now who be di NEC and BoT members wey go attend di meeting, bicos for di national convention for Ibadan on Saturday and Sunday, di PDP elect new national chairman and secretary wey be Kabiru Turaki and Taofeek Arapaja.
Dat convention bin also get di support of di PDP BoT wey di chairman na former Senate President Adolphus Wabara.
But as BBC News Pidgin kontinu to dey monitor updates from di PDP, hia na evritin wey you suppose sabi about all di wahala wey no wan finish for dis party wey bin produce three Nigeria Presidents:
'Illegal' national convention?

Wia dis foto come from, PDP/X
Some top oga dem for di PDP don describe di national convention wey happun for di Lekan Salami Stadium Ibadan, Oyo State ova di weekend, as illegal.
Dis na sake of say di federal high court for Abuja bin order say di convention no fit hold and even order di Independent National Electoral Commission (Inec) say make dem no monitor di process.
Na di former guvnor of Jigawa State Sule Lamido bin carry di mata go court as e claim say di PDP no gree make e buy nomination form to run for di office of national chairman during di convention.
Justice Peter Lifu rule say e dey against di PDP constitution for dem to stop any member wey wan run for any office, so e order say di convention no fit hold unless Lamido go dey allowed to contest for di position wey e want.
During one interview for TV, Lamido tok say im no go witdraw di court mata bicos im dey fight for im right, "and if di convention go ahead, e go dey illegal".
Conflicting court orders
However, di convention organisers claim say dem get anoda order fro di Oyo State High Court wey order dem to go ahead wit di convention and di election of national officers.
According to dem, dis order from Justice Ladiran Akintola bin come on Friday, 14 November, and e compel di PDP to hold dia convention as dem bin don plan am, and for Inec to also monitor am.
Na based on dis Oyo State high court judgement di PDP go on wit dia convention.
One oga for di National Judicial Institute (NJI), Babatunde Adejumo, bin don explain wetin go happen wen two courts wey get di same power give two different orders on top di same issue.
Adejumo wey be di former President of di National Industrial Court, give di explanation on Thursday, 13 Novemba 2025, as e dey ansa questions from tori pipo ahead of di 2025 All Nigerian Judges' Conference.
E say: "If two or three courts give conflicting decision on top di same subject matter, di appellate courts na dem go resolve am. Anytin wey di Supreme Court decide go bicom final and binding," e tok.
So, e dey clear say dis court mata about di PDP national convention neva end.
Wike, Anyanwu, Fayose sacked?

Wia dis foto come from, Sam Anyanwu, Nyesom Wike, Ayo Fayose/X
For di convention, members of di PDP move motion to expel some of dia members wey dem accuse say dem dey anti-party activities.
Di pipo wey dem expel include:
- Nyesom Wike - FCT Minister
- Sam Anyanwu - Nat'l Secretary
- Ayodele Fayose - former Ekiti State guvnor
- Austin Nwachukwu,
- Kamaldeen Ajibade (SAN)
- Umar Bature
- Mohammed Abdulrahman
- George Turner
- Dan Orbih
- Mao Ohuabunwa
"Dis decision dey ratified by overwhelming majority of delegates, and e show say di party dey committed to eradicate internal divisions and anti-party conduct wey don dey delay dia progress," di PDP write for dia verified X handle about di members wey dem pursue.
Reactingtodidevelopment, Lere Olayinka wey be di tok-tok pesin for oga Nyesom Wike say na decision of pipo wey don drink.
"Dem gada for Ibadan to do social party, enjoy diasef and get drunk, dem dey free to tok anytin," Olayinka write for im Facebook handle.
Similarly, Fayose also respond for im handle say "di dead no fit expel di living".
Sum guvnors wash dia hand comot
Meanwhile some serving guvnors of di PDP don wash dia hand comot for di sacking of Wike and im allies from di party.
Guvnor of Adamawa State Umaru Fintiri say im hand no dey for di decision at all and e no support am.
"I believe say dis decision no be in di best interest of di party, and I no go follow for any attempt wey fit carry di PDP into more katakata wey no dey end," Fintiri write for im X handle on Saturday.
E say im advice na "for all di stakeholders to work towards healing di divisions within di party and to strive for unity and cohesion".
Also di guvnor of Plateau State Caleb Mutfwang say di PDP dey for "crucial moment" and for di party to start to dey expel pipo "no dey prudent or constructive".
"Di move to expel Barr. Nyesom Wike, Ayodele Fayose, Samuel Anyanwu, and odas no dey discussed by di PDP Guvnors Forum or presented to di NEC. E no reflect my position or dat of our leadership," e write for im X handle.
However, some oda PDP guvnors like Bala Mohammed of Bauchi and Dauda Lawal of Zamfara, dey in support of guvnor Seyi Makinde of Oyo State, who many say na im be di leader of di oda PDP faction.
Bode George, one of di foudning elders of di PDP, also dey support di Makinde-led faction, and according to reports, na im even move di motion to expel Wike, seconded by Bala Mohammed.
Wetin next?
All eyes go dey on di emergency BoT and NEC meeting wey di Wike-led faction of di PDP don call for Tuesday, 18 November 2025.
As e be now, e no dey clear weda Inec monitor di PDP national convention of November 15 and 16, and weda dem don recognise Turaki and Arapaja as di new national chairman and secretary of di party.
Anoda tin wey neva dey clear na which BoT or NEC members wey go attend dis Tuesday meeting.
Dis na bicos, di acting PDP chairman Umar Damagun and di current BoT chairman Adolphus Wabara both bin support di national convention ova di weekend.
Weda dem go still attend di meeting wey di supposedly suspended Sam Anyanwu dey call, na wetin pipo dey wait to see.









