PDP elect new chairman and secretary as dem pursue Wike, Fayose, Anyanwu sake of alleged anti-party activities

A collage of three men - Kabiru Turaki, Nyesom Wike and Taofeek Arapaja

Wia dis foto come from, Kabiru Tanimu Turaki/Facebook, Lere Olayinka/X, Amb. Taofeek Oladejo Arapaja/Facebook

Read am in 6 mins

Di Peoples Democratic Party (PDP), wey be di major opposition party for Nigeria, don elect Kabiru Turaki (SAN) as dia National Chairman.

PDP for dia national convention for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, southwest Nigeria on Saturday and Sunday elect di former minister of Special Duties and Intergovernmental Affairs.

For di convention wey di party say na ova 3,000 delegates from across Nigeria 36 states and di Federal Capital Territory attend, dem also elect Taofeek Arapaja National Secretary.

"Senator Ben Obi, wey oversee di electoral processes, guide delegates through a transparent voting mechanism wey underscore di PDP's commitment to democratic principles," PDP tok.

PDP pursue Wike, Fayose, Sam Anyanwu and odas sake of alleged anti-party activities

Nyesom Wike

Wia dis foto come from, Lere Olayinka/X

For di convention, di opposition party pursue di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike plus some oda top members of di party sake of accuse say dem do anti-party tins.

Di oda pipo wey dem also pursue na Samuel Anyanwu wey be di National Secretary of PDP bifor dem elect Taofeek Arapaja, Austin Nwachukwu, Kamaldeen Ajibade (SAN), and former govnor of Ekiti State Ayo Fayose.

Odas also na Umar Bature, Mohammed Abdulrahman, George Turner, Dan Orbih and Mao Ohuabunwa.

Ayodele Fayose

Wia dis foto come from, Lere Olayinka/Facebook

Wetin we call dis foto, Former two-time guvnor of Ekiti State Ayodele Fayose na beta ally of Nyesom Wike

For di motion wey members of di PDP move during di convention, dem allege say di members wey dem expel don commit plenty offence against di party constitution, including "supporting and canvassing votes for di opposition".

"Di decision dey ratified by overwhelming majority of delegates, and e show say di party dey committed to eradicate internal divisions and anti-party conduct wey don dey delay dia progress," di PDP write for dia verified X handle.

Howeva, Lere Olayinka wey be di tok-tok pesin for oga Nyesom Wike don respond to di development as e tok say na decision of pipo wey don drink.

"Dem gada for Ibadan to do social party, enjoy diasef and get drunk, dem dey free to tok anytin," Olayinka write for im Facebook handle.

PDP national convention dey go on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X

Dis PDP national convention bin happun in spite of one order by di Federal High Court for Abuja, wey tell di party make dem no go ahead wit di convention.

But anoda High Court for Oyo State also give anoda order say make di convention go ahead and make di Independent National Electoral Commission (Inec) monitor di process.

Sabi pipo bin tok say dis convention na chance for di PDP to put dia house in order as in-house gbas gbos wan scata di party wey bin rule Nigeria for 16 years and bin dey brag say na di biggest party for Africa.

Since afta di 2023 general election, di PDP be like say e divide into two, one part dey loyal to Nyesom Wike, former govnor of Rivers State and di current Minister of di Federal Capital Territory, while di oda faction dey loyal to Seyi Makinde di current govnor of Oyo State.

Di Wike faction include Sam Anyanwu and some former govnors like Samuel Ortom of Benue State, Ifeanyi Ugwuanyi of Enugu State, Ayodele Fayose of Ekiti State, and Okezie Ikpeazu of Abia State.

For di Makinde faction, na some serving govnors like Bala Mohammed of Bauchi State, di acting National Chairman Umar Damagum, and di National Vice Chairman (North Central), Abdulrahman Mohammed dey dia.

Former Senate President Bukola Saraki, wey bin head one reconciliation attempt for di PDP write for im X handle on Thursday say, make di party no go ahead wit dis national convention, rather, make dem appoint caretaker committee wey go take charge for di mean time.

However, on Saturday morning, di PDP Board of Trustees issue statement say dem reject di report of di reconciliation committee wey dey fly around for di media.

Chairman of di PDP BoT, Adolphus Wabara, wey also be former Senate President for Nigeria, tok for di statement say dem for di BoT neva see di report and dem no endorse am.

"Di BoT tanda gidigba to endorse di conduct of di elective National Convention wey dey scheduled for Saturday, 15th to Sunday 16th November, 2025 for Ibadan, Oyo State capital for di purpose of electing new set of leaders to pilot di affairs of di Party for di next four years," di statement tok.

"Di BoT reject any suggestion for Caretaker Committee for di Party. Such idea no fit dey contemplated by di Board."

Who be Kabiru Turaki

Foto of Kabiru Turaki

Wia dis foto come from, @OfficialPDPNig/X

Dem born Kabiru Turaki for 1957 for Birnin Kebbi, Kebbi State. Turaki bin attend di University of Jos, Plateau State, wia e graduate wit Bachelor's degree in Law.

E dey hold di traditional titles of Dan Masanin Gwandu and Zarumman Kabbi for im community.

For 2013, former President Goodluck Jonathan swear-in Turaki as Minister of Special Duties and Intergovernmental Affairs

E get ova 25 years experience in di private and public sectors and e become Senior Advocate of Nigeria (SAN) for 2002.

Turaki na principal partner at K.T. Turaki and Co. Solicitors and Advocates. E bin contest for govnor for Kebbi State for 2011. Na ogbongbe politician wit di PDP until im become di PDP National Chairman.

Who be Taofeek Arapaja?

Dem born Taofeek Arapaja for 1958. For 2003-2007, Arapaja bin represent Ibadan South East/Ibadan North East Federal Constituency for di Federal House of Representatives.

For 2007, Arapaja become deputy govnor to Otunba Christopher Adebayo Alao Akala of Oyo State.

Until im appointment as National Secretary, Arapaja bin serve as di Deputy National Chairman (South).

For 2012, Arapaja serve as di Nigerian ambassador to di Hashemite Kingdom of Jordan.

For April 2014, Arapaja become di ambassador to Republic of Iraq.

Fotos from di PDP national convention

PDP national convention going on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X

PDP national convention going on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X

PDP national convention going on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X

PDP national convention going on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X

PDP national convention going on for Lekan Salami Stadium, Ibadan Oyo State, Southwest Nigeria.

Wia dis foto come from, PDP/X