Baba Ijesha regain freedom afta three years in prison ova sexual assault conviction

Nollywood actor Baba Ijesha wear yellow top use face mask
Read am in 5 mins

Nollywood actor, Olarenwaju Omiyinka, wey pipo sabi as Baba Ijesa, don regain freedom from prison.

Baba Ijesha lawyer, Barrister Olabiran Kayode wey confam im release give BBC News Pidgin on Saturday, 15 November tok say na afta one Court of Appeal judgment clear am of di accuse of sexual assault on a minor.

Di lawyer tok say na on Friday, 14 November, di court declare am innocent of two count charges, out of di four charges wey Lagos state govment lawyers sama am.

Baba Ijesha freedom dey come afta e spend more dan three years for prison.

Di lawyer tell BBC News Pidgin say im go give full details on di Appeal court judgement soon.

For 2022, Lagos State goment lawyers alias prosecutors drag am to court on alleged sexual assault of a 15-year-old.

Baba Ijesha na popular Nigerian feem actor wey dey popular for Yoruba movies.

Tori be say di victim na di adopted daughter of one Nigerian comedienne, Damilola Adekoya wey pipo sabi as Princess.

Baba Ijesha case verdict - How court bin judge di mata

Na on 14, July, 2022, one Lagos State High Court for Ikeja bin find Baba Ijesha guilty of sexual assault of a minor.

Justice Oluwatoyin Taiwo of di Ikeja Sexual Offences Court for her ruling bin sentence Baba Ijesha to five years in prison.

Earlier, Lagos state govment bin arraign di defendant bifor di court on 24 June, 2021 on a six (6) count charge of:

  • Sexual assault by penetration (2014)
  • Indecent treatment of a child
  • Sexual assault of (2011)
  • Indecent treatment of a child (2015)
  • Sexual assault (2015)
  • Attempted sexual assault by penetration (2021)

Di judge for her ruling tok say di prosecution bin successfully prove di charge of sexual assault of a minor and indecent treatment of a minor against di defendant.

Di judge, however, discharge and free am of count one and six, wey be sexual assault by penetration (wey happun for 2014) and attempted sexual assault by penetration, wey happun for 2021.

Court bin find Baba Ijesha guilty and sentence am to five years imprisonment on four count charges, and say di sentence go run concurrently.

"Court find di defendant guilty and sentenced to five years imprisonment for count two (2), three years for count three (3), five years for count four (4) and three years for count five (5) taking effect from today, 14th of July, 2022. Di sentences are to run concurrently." Di court bin rule.

E serve im jail term in full - Comedienne Princess

Di Nigerian comedienne Damilola Adekoya alias Princess wey accuse Baba Ijesa say e sexually molest her foster teenage wey lead to im conviction don react to im release from prison.

On her official IG account, Princess clear am say di tori wey dey fly up and down say na one Court of Appeal judgement release di actor no be true.

She say Baba Ijesha don fully serve im prison sentence, dat na why e dey released from prison, no be any Appeal court ruling reduce im sentence as actor Yomi Fabiyi dey claim.

"Baba Ijesha don serve im full term for dis offence wey I report. E appeal di case several times but di appeal court throw am out. Di last time di Appeal court uphold di judgement of di high court and rule say make e go serve im jail term. Nothing like say dem acquit am. E serve im term for dis crime in full," Princess tok

She recount say di Lagos state high court for 2022 bin sentence Baba Ijesha to 16 years in prison in total afta dem find am guilty of sexual assault of a minor, but di judge say make e serve di term concurrently, wey be five years and e don serve im term fully.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

One video wey BBC New Pidgin neva fit confam begin trend on Saturday, wey show di actor for inside one motor dey make call and dey tok wit Yoruba language.

For di video, e bin tok say, "Apase, I don come out… I just come out. I wan relax. I just want comot here, so I decide to inform you. Thank you for supporting me. I go call you."

Earlier, Nollywood actor Yomi Fabiyi wey be supporter of Baba Ijesha bin post on im official Instagram account say Baba Ijesha don regain freedom.

BBC News Pidgin bin react out to am, and e confam say dem bin challenge di four count charges wey prosecutors sama am for di Court of Appeal.

E say di court tok say enough prove no dey to confam say di actor defile di alleged minor wen e either be 7 or 14-year-old as di prosecutors claim for di charges.

Fabiyi say di Appeal court don clear Baba Ijesha of two of charges and di remaining two charges dey bifor di Supreme Court.

E add say though di actor don already serve di five-year jail term wey di state high court bin sentence am to.