'Leave BBL, do squats' - King of Squats advise women wey wan improve dia body
Popular South African fitness trainer Nkululeko Dlamini don advise women against Brazilian Butt Lift (BBL) surgery.
E say regular squatting exercise fit give dem dia dream body shape.
Di trainer wey dey popularly known as King of Squats Nyawolomshini sake of im squatting exercise bin visit Nigeria recently for one event.
For inside interview wit BBC Pidgin, e say squatting na ogbonge exercise wey no go only give pipo wey dey consistent di desired body shape but also get plenty benefits wey include strengthening of di muscle and di core, e dey help di knees, di glutes and di thighs and di curves too.
"Squats dey make di whole body function well, e go give you beta body shape, for women wey desire hot backside, e go give you and you no go need do BBL as we no dey promote am bicos e get plenty side effects," Nyawolomshini tok.

Ova di years, pipo don drag Nyawolomshini sake of say im backside be like woman own, but e say im no send anybody - wetin im dey preach, e get am and di result choke.
On how e take dey handle criticism, di fitness trainer say im no care wetin pipo tok, "if dem tok negative about me, I go turn am to positive. All dia tok-tok dey promote me and dem dey help me go viral. I dey do something wey dey right dat na why dem dey tok, if not nobody go send me."
Bifor, e go into fitness trainer fully as profession, King of Squats bin work as teacher, and e play football, but e say e find im passion for squats and don help plenty pipo dey fit and healthy.
Wetin be squats?
Squats na full body move wey dem dey call "di king of all exercises." Na exercise wey go make pesin lower di hips from a standing position.
Squats na strength exercise wey dey strengthen di muscles, and dey give stability.
One study by UK researchers discover say squatting dey among di best way to reduce blood pressure.
One analysis wey dem publish for di British Journal of Sports Medicine, of trials bin involve 16,000 pipo and dem find say di exercise reduce dia high blood pressure.
Benefits of squatting exercise
According to sabi pipo 'healthline', squats dey:
- Strengthens your core
- Reduce di risk of injury
- Burn calories
- Strengthen movement in tendons, bones, and ligaments around leg muscles.











