BBC Pidgin WhatsApp Channel: how to join and get di best news updates

Photo of hand wey hold phone wit WhatsApp on di screen

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

You fit now get di most important breaking news, analysis and special features by BBC News Pidgin directly on your WhatsApp.

Our journalists dey bring you di best local and global tori in text and video especially for di followers of our new channel on di messaging app.

Launched in 2023, WhatsApp Channels dey allow users to receive updates from pipo and organisations dem dey interested in. Launched in September 2023, di BBC WhatsApp Channel for UK don reach more dan 1.3 million followers.

Now our readers for Nigeria, Ghana, Kenya, among odas, fit also get di best BBC content in Pidgin on dia phones.

  • Click here to subscribe to our WhatsApp channel if you dey use your mobile phone or WhatsApp Web.
  • If you dey read dis on your computer, just scan di QR code below:
BBC News Pidgin WhatsApp channel QR code
Wetin we call dis foto, BBC News Pidgin WhatsApp channel QR code
  • You fit also search for BBC News Pidgin under di "Updates" tab on WhatsApp.

You fit find di "Updates" tab at di bottom-left of your screen if you dey use iPhone, or at di top of your screen if you dey use Android.

Dat na wia all of our messages go appear - separately from your regular "Chats" tab.

Press di bell at di top of di Channel and unmute am so you no go miss any update. You fit mute am again or unsubscribe to di channel anytime.

You fit react to our tori by using emojis and easily forward di best ones to your personal contacts and groups on WhatsApp.

Meta, di owner of WhatsApp, Facebook and Instagram, tok say no one in di channel go fit see your contact details, photo, name, or phone number.

Learn more about your privacy on di BBC WhatsApp Channels and Communities Privacy Notice.

Photo of hands wey hold phones wit WhatsApp on di screens

Wia dis foto come from, Getty Images