Di BBC WhatsApp Channels and Communities Privacy Notice
Your trust dey veri important to us. E mean say di BBC dey committed to protect di privacy and security of your personal data. E dey important make you read dis notice so you go sabi how and why we dey use such personal data. Dis privacy notice describe how we dey collect and use personal data about you during and afta your relationship wit us, in accordance wit data protection law.
Which personal data di BBC go collect and how we dey use am
Di BBC go collect and process di personal information wey you choose to provide to use as part of joining and following our channels and communities. Dis information fit include some or all of di following data wey dey listed below.
Personal data
Di personal data wey fit dey collected na:
- Handle/display name for your WhatsApp profile
- Your contact number, such as mobile number
- Display pictures
Although e depend on di nature of your display picture and your privacy settings, e dey possible say di BBC go also collect and process sensitive information, also known as special category data wey you choose to disclose. Dis fit include for example:
- Your race or ethnicity
- Your health information
- Your religious or philosophical beliefs
- Your sexual orientation
- Political opinion
Setting your WhatsApp display picture settings to private
Please know say if you allow evri one to see your display picture for your WhatsApp account, di BBC fit see dis information too. You dey encouraged to change your privacy settings to ‘contacts only’ to reduce di personal information you share through WhatsApp wit us.
Who be di Data Controller?
Di BBC na independent data controller of any personal information wey you provide to us wey we store on BBC devices and systems.
End of Di one wey oda users dey read well well
WhatsApp na independent "data controller" of any data wey you send via di app. Please know say you also dey subject to WhatsApp Privacy Policy and Terms of Service. WhatsApp fit share your data within di Meta Companies.
Each controller dey decide to which extent dem dey process your personal information, wetin dem dey use am for, and di ways dem dey process am. Make we clear you, your personal information go dey collected and processed by di BBC only for di purpose wey dey inside dis privacy notice, wey be to join and follow di BBC WhatsApp Channel. Each controller get responsibility to comply, and to demonstrate compliance wit data protection law.
Lawful basis for processing your personal data
We rely on consent to use di personal data about you. Dis na sake of say you don actively decide to enta our WhatsApp Channels broadcast. If you wish to stop receiving dis broadcasts you fit withdraw your consent at any time by removing yoursef from di channel.
Sharing your information
Di BBC no go share your personal data wit any third party witout your permission.
Retaining your information
Di BBC go process your personal data for di period during which e dey necessary to fulfil di purposes wey dey inside dis privacy notice.
Your rights and more information
You get rights under di UK data protection law. You fit request a copy of di data di BBC store about you, wey include your BBC Account data and di data wey we describe above as long as we hold dis data.
You fit contact us via our email address [email protected]. If you get questions or you wish to find out more details about your rights, please visit di BBC Privacy and Cookies Policy at http://www.bbc.co.uk/privacy.
If you get concern about di way di BBC handle your personal information, you fit raise your concern wit di supervisory authority for UK, di Information Commissioner’s Office (ICO) https://ico.org.uk/.
Updating dis privacy notice
We go revise di privacy notice if ogbonge changes dey on how we use your personal data.











