Baftas 2026: How Nigerians dominate di British awards winners list

Wunmi Mosaku, Akinola Davies Jr., Wale Davies and Ryan Coogler wit dia Bafta Awards

Wia dis foto come from, Joe Maher/BAFTA/Getty Images for BAFTA, James McCauley/Variety via Getty Images

Read am in 5 mins

Nigerian born actress Wunmi Mosaku don make history as di first black British pesin to win di Best Supporting actress for Baftas.

She win based on di 2025 hit horror feem wey dem call Sinners wia she bin act as Annie.

Di British actress wey comot from Zaria, Nigeria at di age of one go Manchester tok about her win say, "I bin find part of myself for Annie, a part of my hopes, my ancestral power and connection, parts I bin tink say I don loose or try to dim sake of say I be immigrant wey dey try fit in".

Apart from her, di second winner na for di Outstanding debut by a British writer, director or producer category. Dis category bin dey worn by di Lagos set feem, My Father's Shadow.

Dis go be di first full length feem wey Nigerian raised director, Akinola Davies Jr. go direct. E bin write di feem wit im broda wey be musician for di rap group Show Dem Camp, Wale Davies wey also gbab win for di category.

Di feem na about two boys wey no really gbadun dia papa bin dey follow am waka during di 1993 general elections and how dem bin navigate dat period. Di feem get im world wide debut for di 2025 Cannes feem festival wia e become di first Nigerian feem wey go dey inside di official selection of di festival.

Oda feems wey win big for di award night na One Battle After Another wey get di most awards for di night as dem win six awards. I Swear, Sinners and Frakenstein win three awards each and Hamnet gbab two.

Dis na di full list of di winners and nominations.

Best feem

  • Winner: One Battle After Another
  • Hamnet
  • Marty Supreme
  • Sentimental Value
  • Sinners

Outstanding British feem

  • Winner: Hamnet
  • 28 Years Later
  • The Ballad of Wallis Island
  • Bridget Jones: Mad about the Boy
  • Die My Love
  • H Is For Hawk
  • I Swear
  • Mr Burton
  • Pillion
  • Steve

Leading actress

  • Winner: Jessie Buckley - Hamnet
  • Rose Byrne - If I Had Legs I'd Kick You
  • Kate Hudson - Song Sung Blue
  • Chase Infiniti - One Battle After Another
  • Renate Reinsve - Sentimental Value
  • Emma Stone - Bugonia

Leading actor

  • Winner: Robert Aramayo - I Swear
  • Timothée Chalamet - Marty Supreme
  • Leonardo DiCaprio - One Battle After Another
  • Ethan Hawke - Blue Moon
  • Michael B Jordan -Sinners
  • Jesse Plemons - Bugonia
One Battle After Another's Leonardo DiCaprio, Teyana Taylor, Paul Thomas Anderson, Sara Murphy, Chase Infiniti and Benicio del Toro in smart clothes at the awards

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One Battle After Another's Leonardo DiCaprio, Teyana Taylor, Paul Thomas Anderson, Sara Murphy, Chase Infiniti and Benicio del Toro were at the ceremony

Supporting actress

  • Winner: Wunmi Mosaku - Sinners
  • Odessa A'zion - Marty Supreme
  • Inga Ibsdotter Lilleaas - Sentimental Value
  • Carey Mulligan - The Ballad of Wallis Island
  • Teyana Taylor - One Battle After Another
  • Emily Watson - Hamnet

Supporting actor

  • Winner: Sean Penn - One Battle After Another
  • Benicio del Toro - One Battle After Another
  • Jacob Elordi - Frankenstein
  • Paul Mescal - Hamnet
  • Peter Mullan - I Swear
  • Stellan Skarsgård - Sentimental Value

Director

  • Winner: One Battle After Another - Paul Thomas Anderson
  • Bugonia - Yorgos Lanthimos
  • Hamnet - Chloé Zhao
  • Marty Supreme - Josh Safdie
  • Sentimental Value - Joachim Trier
  • Sinners - Ryan Coogler

Outstanding debut by a British writer, director or producer

  • Winner: My Father's Shadow
  • The Ceremony
  • Pillion
  • A Want In Her
  • Wasteman

Feem wey no dey in English language

  • Winner: Sentimental Value
  • It Was Just An Accident
  • The Secret Agent
  • Sirât
  • The Voice of Hind Rajab

Outstanding British contribution to cinema

Winner: Claire Binns, creative director of Picturehouse Cinemas and Picturehouse Entertainment

Documentary

  • Winner: Mr Nobody Against Putin
  • 2000 Meters to Andriivka
  • Apocalypse in the Tropics
  • Cover-Up
  • The Perfect Neighbor

Animated film

  • Winner: Zootropolis 2
  • Elio
  • Little Amélie

Children's and family feem

  • Winner: Boong
  • Arco
  • Lilo & Stitch
  • Zootropolis 2

Original screenplay

  • Winner: Sinners
  • I Swear
  • Marty Supreme
  • The Secret Agent
  • Sentimental Value

Adapted screenplay

  • Winner: One Battle After Another
  • The Ballad of Wallis Island
  • Bugonia
  • Hamnet
  • Pillion

EE Bafta rising star award (wey public vote for)

A green Bafta Rising Star Award trophy - of a generic face

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, The Rising Star Award is distinct from the other golden Bafta trophies
  • Winner: Robert Aramayo
  • Miles Caton
  • Chase Infiniti
  • Archie Madekwe
  • Posy Sterling

Original score

  • Winner: Sinners - Ludwig Göransson
  • Bugonia - Jerskin Fendrix
  • Frankenstein - Alexandre Desplat
  • Hamnet - Max Richter
  • One Battle After Another - Jonny Greenwood

Casting

  • Winner: I Swear
  • Marty Supreme
  • One Battle After Another
  • Sentimental Value
  • Sinners

Cinematography

  • Winner: One Battle After Another
  • Frankenstein
  • Marty Supreme
  • Sinners
  • Train Dreams

Costume design

  • Winner: Frankenstein
  • Hamnet
  • Marty Supreme
  • Sinners
  • Wicked: For Good

Editing

  • Winner: One Battle After Another
  • F1
  • A House of Dynamite
  • Marty Supreme
  • Sinners

Production design

  • Winner: Frankenstein
  • Hamnet
  • Marty Supreme
  • One Battle After Another
  • Sinners

Make-up and hair

  • Winner: Frankenstein
  • Hamnet
  • Marty Supreme
  • Sinners
  • Wicked: For Good

Sound

  • Winner: F1
  • Frankenstein
  • One Battle After Another
  • Sinners
  • Warfare

Special visual effects

  • Winner: Avatar: Fire and Ash
  • F1
  • Frankenstein
  • How to Train Your Dragon
  • The Lost Bus

British short feem

  • Winner: This Is Endometriosis
  • Magid / Zafar
  • Nostalgie
  • Terence
  • Welcome Home Freckles

British short animation

  • Winner: Two Black Boys in Paradise
  • Cardboard
  • Solstice