Violence spread for Mexico afta killing of drug lord El Mencho

Wetin we call dis Video, Watch: Dem put fire for for cars across Mexico as violence begin spread
    • Author, Ottilie Mitchell
  • Read am in 4 mins

Violence don begin spread for Mexico afta security operation wey happun in collabo wit US intelligence kill di kontri most wanted drug baron.

Nemesio Oseguera Cervantes, alias "El Mencho", na di leader of di Jalisco New Generation (CJNG) drug cartel wey pipo dey fear well-well and e die afta e seriously wunjure for clashes between im supporters and di army on Sunday.

Four CJNG members die during di operation for di town of Tapalpa, wey dey central-western Jalisco state, and three army personnel also wunjure, di Mexican defence ministry tok.

Revenge for di drug lord death don see violence spread to at least a dozen states, wit CJNG blocking roads wit burning vehicles.

Firefighters work to off fire wey dey burn one bus for Puerto Vallarta, Mexico.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Firefighters work to off fire wey dey burn one bus for Puerto Vallarta, Mexico.

Throughout Sunday, tori come out say gunmen on di streets in Jalisco and oda places.

Eyewitnesses film plenty smoke dey rise over several cities including Guadalajara - one of di host cities of di Fifa World Cup wey go happun soon.

Jalisco Governor Pablo Lemus Navarro declare code red for di state, pause all public transport and also cancel mass events and in-person classes.

Tourists wey tok to Reuters describe di resort town of Puerto Vallarta, Jalisco, as "war zone".

Some 250 roadblocks na im dem mount across di kontri during di kasala, wit 65 for Jalisco, di BBC US news partner CBS report. In di latest update, di Mexican Security Cabinet say four blockades remain active for Jalisco.

Di cabinet say 25 pipo don chop arrest, 11 for dia alleged participation in violent acts and 14 more for alleged looting and pillaging.

Dem set some shops fire and attack about 20 bank branches for di violence, dem add.

Thick smoke dey rise along di waterfront in Puerto Vallarta

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Thick smoke dey rise along di waterfront in Puerto Vallarta

Mexican President Claudia Sheinbaum tok say "absolute coordination" dey between state and federal officials in response to di violence, and tell din pipo make dem stay "calm and informed".

Sheinbaum add say "in most parts of di kontri, activities dey go on normally".

Several airlines don cancel flights to Jalisco, including Air Canada, United Airlines and American Airlines.

Di US don warn dia citizens to dey safe for five states: Jalisco, Tamaulipas, areas of Michoacán, Guerrero and Nuevo Leon.

Di UK govment say "serious security incidents" don come out of Jalisco, adding "you gatz exercise extreme caution" and follow di advice of local authorities.

Late on Sunday night, US Press Secretary Karoline Leavitt tok say El Mencho na "top target for di Mexican and United States govment as one of di top traffickers of fentanyl into our homeland."

She say three cartel members na im dem kill, anoda three wound and two chop arrest for di operation, wey di US provide intelligence for.

A reward poster for El Mencho

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di bin offer $15m (£11.1m) bounty for information on who sabi wia El Mencho dey

El Mencho, a 59-year-old former police officer, run very big criminal organisation wey dia work na to traffic huge quantities of cocaine, methamphetamine and fentanyl into di US.

Di US State Department bin offer a $15m (£11.1m) reward for information wey go lead to El Mencho capture.

For statement, di Mexican defence ministry say na di kontri special forces "plan and execute" di operation.

Mike Vigil, former Chief of International Operations for di US Drug Enforcement Administration, describe di operation as "one of di most significant actions wey don happun in di history of drug trafficking". E dey tok to CBS, di BBC US news partner.