Who be alleged drug kingpin Ryan Wedding compared to Pablo Escobar wey FBI gbab

Wia dis foto come from, Andrew Harnik/Getty Images
Di Canadian snowboarder and alleged drug smuggler Ryan Wedding don chop arrest and dey for custody.
FBI Director Kash Patel confam di news inside one post for X.
E write: "Tanks to President Trump leadership and commitment to global law enforcement - as of dis morning, di DOJ/FBI officially gbab our SIXTH Top Ten Most Wanted Fugitive within di last year.
"Tank you to @AGPamBondi for her relentless pursuit of justice, di US Attorney Office for L.A., and FBI Los Angeles. Ryan James Wedding bin enta custody for Mexico last night. E dey transported from Mexico to di U.S. via FBI FTOC to face justice.
"Wedding dey believed to dey hide for Mexico for ova ten years - and don dey wanted on charges of cocaine trafficking and murder since 2024."
Meanwhile, Attorney General Pam Bondi confam say dem don fly Wedding into di United States from Mexico.
Inside post on X, she write say at her direction, FBI agents gbab Wedding, "di onetime Olympian snowboarder-turned alleged violent cocaine kingpin".
"Wedding bin dey flown to di United States wia e go face justice. Dis na direct result of President Trump law-and-order leadership," she continue.
Bondi further credit FBI Director Kash Patel, Ambassador Ron Johnson, and di Mexican authorities for assisting in di case.
FBI Director Kash Patel say Mexico co-operation for di operation dey important.
"Dis operation na di result of tremendous cooperation and team work wit di Govment of Mexico. Special tanks to our amazing partners for Mexico wey bin facilitate dis - President Sheinbaum, Secretary Harfuch, Ambassador Ron Johnson, Legat Mexico, and more," e write for social media.
E confam say dem gbab Wedding for Mexico City on Thursday night.
Patel say di FBI also gbab anoda high profile suspect for Mexico wey e only identify as Castillo.
E say dem don bring am to di US along wit Wedding.
Wetin Wedding dey accused of?
Ryan Wedding chop accuse say e dey run vast drug trafficking operation wey dey responsible for importing some 60 metric tons of cocaine a year into Los Angeles, Attorney General Pam Bondi previously tok.
Di organisation bin operate across North America and oda kontris and also be di largest supplier of cocaine to Canada - and e dey bring in estimated $1bn a year.
Bifor dem gbab am, Wedding bin dey accused of killing one federal witness inside one case against am.
Dem charge Wedding wit witness tampering and intimidation, murder, money laundering and drug trafficking.
Who be Ryan Wedding?
Ryan Wedding na former snowboarder wey bin represent Canada for di 2002 Winter Olympics, and compete for di Parallel Giant Slalom.
Dem born am for September 1981 for Thunder Bay, Ontario, to one family wey bin dey involved in snow sports. Afta di Olympics, e bin study briefly for Simon Fraser University for British Columbia.
For 2009, Wedding chop conviction for federal court for California afta dem charge am wit conspiracy to distribute cocaine. E bin serve time for prison and dem release am for December 2011.
Canadian and US officials don accuse Wedding say e still dey involve in drug trafficking and say e don dodge arrest arrest for many years.
Di FBI allege say e don order dozens of murders across di world, including for US, Canada and Latin America.










