NDLEA arrest popular Lagos socialite Pretty Mike and ova 100 odas

Wia dis foto come from, Pretty Mike/Instagram
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don arrest one popular Lagos socialite Mike Eze Nwalie Nwogu alias Pretty Mike and don take am into custody for screening.
For one statement wey NDLEA release, di anti-drug agency say dem arrest Pretty Mike and ova 100 suspects for im club – Proxy Night club wia alleged drug party bin dey go on for di early hours of Sunday, 26 October.
"NDLEA operatives for di early hours of Sunday 26th October bin raid Proxy Night club for 7 Akin Adesola Street, Victoria Island wia one (alleged) drug party bin dey go on. Ova 100 suspects including di owner of di club Mike Eze Nwalie Nwogu alias Pretty Mike, don dey arrested and taken into custody for screening."
Although, NDLEA no tok why dem arrest am, but dem say dem recover cartons of illegal substances wey include Loud and laughing gas from suspects for di party and for di store.
Di statement wey tok-tok pesin Femi Babafemi sign add say operatives of di agency bin carry out di raid following intelligence report about di alleged drug party.
"NDLEA operatives wey station for di party between 11pm on Saturday 25th October however scata di party at 3am on Sunday 26th October based on Standard Operating Procedures (SOPs)," di statement tok.
Pretty Mike dey popular for im weird fashion sense wey e take dey storm pipo event.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
During di raid, di enforcement agency tok say dem recover 450,000 pills of narcotics and thousands of tablets and capsules, (tramadol and exol-5), 70 parcels of cocaine (3.60kg), wey dey go UK, 21,950 capsules of tramadol, 234.5 kilograms of skunk, and 121.3 litres of skuchies, among odas.
Who be Pretty Mike?
Pretty Mike na Nigerian socialite, entrepreneur, and di owner of Proxy Night club for Lagos, Nigeria.
E get reputation of entering famous pipo events in a loud manner wey dey make pipo shock wey go trend for days.
From showing up for weddings wit women on dog leashes to escorting women wey carry belle, to carrying pesin wey dress like spiritualist enta event, Pretty Mike don tiff spotlight for different events witout care.
For one interview wit BBC News Pidgin for 2021, e say evritin im dey do na entertainment and pure cruise.
E explain say to come up wit di ideas of di appearance na inspiration and e dey sometimes take time and months of planning.
On how e dey handle critics, Pretty Mike say im don develop thick skin, and normally pipo go tok, but im no dey allow dia toks affect am.








