Police gbab two pipo on top accuse say dem tiff jewels for Louvre Museum for Paris

Stolen jewels on display

Wia dis foto come from, AFP

    • Author, Jake Lapham
  • Read am in 3 mins

Dem don arrest two suspects on top di theft of precious crown jewels from Paris Louvre Museum, French media tok.

According to Le Parisien newspaper, di men bin originally come from di Parisian suburb of Seine-Saint-Denis, and one of dem bin dey prepare to board one flight from Charles de Gaulle Airport.

Dem tiff items of great value from di world most-visited museum last Sunday, wen four thieves wey carry power tools break enta di building for broad daylight.

France justice minister bin agree say security protocols "fail", and e leave di kontri in "terrible image".

Reports say police arrest di suspects, wey dem sabi well-well sake of previous burglaries, on Saturday evening.

Specialist police now don take ova di case and fit question dem for up to 96 hours.

Di BBC don contact di Paris Public Prosecutor Office.

Di gang reportedly land di museum for 09:30 (06:30 GMT), shortly afta e open to visitors.

Di suspects bin come wit one vehicle-mounted mechanical lift to gain access to di Galerie d'Apollon (Gallery of Apollo) through one balcony wey dey close to di River Seine.

Fotos from di scene show di ladder wey lead up to a first-floor window.

Two of di thieves enta inside by cutting through di window wit power tools.

Dem later threaten di guards, wey evacuate di premises, and cut through di glass of two displayed cases wey contain di jewels.

One preliminary report don show say one in three rooms for di area of di museum wey di robber raid no get CCTV cameras, according to French media.

French police tok say di thieves bin dey inside for four minutes and dem escape on two scooters wey bin wait outside at 09:38.

Officials say dem don tighten security measures around France cultural institutions.

Aerial view of di Louvre Museum for Paris, France, wit di museum outlined in yellow along di River Seine. Key locations within di museum dey labelled, including di Mona Lisa, Louvre Pyramid and Gallery of Apollo.

Similar thefts don happun bifor?

For 1911, one Italian museum employee bin run wit di Mona Lisa under im coat afta e lift di painting.

Authorities recover am afta two years and di culprit later tok say im dey motivated by di belief say di Leonardo da Vinci masterpiece belong for Italy.

For 1998, dem tiff di Le Chemin de Sevres - one 19th century painting by Camille Corot - and dem no ever see am.

Recently, rise don dey for thefts wey dey target French museums.

Last month, thieves bin break into di Adrien Dubouche Museum for Limoges and tiff porcelain works wey reputedly worth €9.5m ($11m / £8.25m).

For November 2024, dem tiff seven items of "great historic and heritage value" from di Cognacq-Jay Museum for di capital. Dem recover most of dem some days ago.

Di same month, armed robbers bin raid di Hieron Museum for Burgundy, and escape wit millions of pounds worth of 20th century artworks.